Omo, see as our guy Paul Onuachu don land for Turkey again come dey scatter net like say him na Haaland wey chop correct amala before match.

Paul Onuachu net em first goal for Trabzonspor

The home team open their Super Lig season against Kocaelispor, and na Onuachu wey carry dem matter for head like Champions League final, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Paul Onuachu Tear Net Early For Second Half Help Em Team Gain Three Points

Match start wey everybody dey do “try your luck” first half, no goal. Second half never even reach 5 minutes, na so wahala burst.

Kocaelispor keeper try clear ball from corner kick, but the thing bounce go Mustafa Eskihellac leg.

Paul Onuachu score em first goal for Trabzonspor vs Kocaelispor

My guy just whip am back inside box — next thing, Onuachu rise like Ronaldo wey dey find Ballon d’Or, boom! Header enter net. 1-0. Papara Park don turn beer parlour.

  Super Eagles Senior Man Muscle Don Vex: Anthony Nwakaeme Injury Na Big Blow for Trabzonspor

Anthony Nwakaeme still dey the game too, dey ginger boys like midfield general wey no wan lose bet money. Him play till 84th minute before Arif Bosluk come replace am.

Make we no lie, Onuachu fit no be demon for Southampton — 4 goals, 1 assist in 40 games.

But for Trabzonspor first time, the guy na menace: 17 goals, 4 assists in just 25 matches. Now him don return and still dey vex defenders like say dem borrow him money.

  Rafiu Durosinmi Don Talk on the Kind Super Eagles Legacy Wey He Wan Build After His First Call-Up

Onuachu Don Return to Super Lig to Spark Big Impact

77 minutes na wetin him play before coach carry am comot for Felipe Augusto. But the damage don already dey.

Paul Onuachu dey celebrate em first goal of season for Trabzonspor vs Kocaelispor

The Trabzonspor just lock shop, pack bus, and collect three points like say na World Cup knockout stage.

If PaulOnuachu continue like this ehn, defenders for Turkey go soon dey pray for injury break.

This one na pure Naija striker wey sabi combine beans power with football sense. Na goal machine wey no need GPS to find net.

  Paul Onuachu Don Wake Up! Two Goals as Trabzonspor Scatter Gençlerbirliği — Samuel Kalu and Peter Itodo shine
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 12, 2025 5:34 am by Hitvibz Media