Na one kain emotional night dey load for France as Moses Simon go enter field for Stade Sebastien Charlety on Friday to face em former club.
The Nigerian baller don ready to chop grass again, and e sweet-and-bitter small because na Nantes — em former club — dey waka come challenge Paris for Ligue 1, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Moses Simon Emotional Comeback vs Nantes
The stage don set as Paris go host di Canaries for matchday nine. For the first time since he comot for summer, Simon go jam him ex-club wey he love scatter. Six seasons no be beans — and na there em blow, na there he turn legend.
The guy even yarn for press conference say, “I for fit stay there for 20 years” — you don see love? He still hold Nantes for chest like agbado for pocket.
Simon play 201 matches, knack 37 goals, drop 42 assists and still help di Canaries lift Coupe de France for 2022. No be small thing.
E pain the fans when he comot, but as Paris drop €6.5m and big project promise, matter finish.
Paris FC Dreams, Memories of Former Team, Banter Still Full Ground
Simon still dey hail him old guy — Chidozie Awaziem and some other Nantes padi dem. But he drop one sharp banter:
“We no even discuss the match, because we know say we go win.” Na so he talk laugh join am. Swagger full everywhere.
Right now, Simon don turn one of the poster boys for Paris rebuilding mission. Dem wan stay Ligue 1, dem wan prove point, dem wan shock big teams — simple.
Paris Ambition vs Nantes Tradition – Who Go Burst Net?
Simon don start season with two goals and two assists, but coach Stéphane Gilli still dey ginger am: “Be more consistent.” Simon sef gree, say coach no lie.
Ahead of big games against di Canaries, Lyon and Monaco, na now Paris go know whether dem be real street boys or just noise makers.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on October 24, 2025 12:54 pm by Hitvibz Media




Stay connected