Super Eagles keeper Victor Sochima don carry him bag enter Zambia go sign two-year deal with Zesco United. Bros no dey play o. Na new chapter be dis for di 26-year-old wey dem dey hail as Odogwu.

Victor Sochima na em be Zesco United signing for 2025

Before him waka enter Ndola, Sochima bin dey South Sudan dey shine for Jamus FC.

As e reach there, na league plus cup he pack comot like say na him be landlord of the country, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Sochima Go Add Pepper for Zesco United Pot

Zesco United no even hide mouth. Dem yan say dem don land better keeper wey go balance dia post well. See as dem hype am like say dem just sign Neuer.

Victor Sochima don become Zesco United new signing for 2025

Na Toaster Nsabata waka go South Africa go join Sekhukhune United, and Zesco no gree make dia post open like gate for Sunday service. Na so dem grab Sochima sharp-sharp.

  Franklin Tebo tear LOSC Lille net for Europa League, help Crvena Zvezda chop small win

And e sweet dem well because CAF Confederation Cup dey front. Ndola giants go knack Gabon’s FC 105 for preliminary round.

With Sochima behind net? Dem dey reason say na clean sheet dem go dey package.

Super Eagles goalkeeper Victor Sochima don run join Zesco United

From Naija Streets to Zambia: Sochima Story No Be Beans

Before him waka enter Zambia, Sochima don already show say e no be small pikin for goalpost.

For Rivers United, bros keep 16 clean sheets for NPFL 2021/22 season. Na record! Na why dem dey call am SochiBig16.

That season, e chop Team of the Season slot, Goalkeeper of the Year nomination, plus Super Eagles call-up.

  Emmanuel Fernandez talk say di honour “mean a lot” after he enta PFA Scotland Team of the Year

Super Eagles goalkeeper Victor Sochima don join Zesco United

Guy even wear Naija jersey four times, play qualifiers against Sierra Leone and Equatorial Guinea. No be beans.

E don also taste Tanzania ball with Tabora United. Anywhere him land, e dey adapt like chameleon. Now, na Zambia go enjoy am.

Everybody dey yarn say this move na upgrade — both for him career and for Zesco wey dey chase continental glory.

Zesco Dey Hype Am Like New Signing for FIFA Career Mode

Zesco United no even calm down. For dia socials, dem drop statement wey sweet like jollof:

Zesco United don unveil Nigerian goalkeeper Victor Sochima

We dey happy to announce di signing of Nigerian international goalkeeper. We sure say Sochima go bring mad skills and experience join our squad. Abeg make una welcome am well!”

As e be so, Ndola fans go soon dey shout “Odogwu!!!” anytime he catch ball. And if e begin dey save penalties? Forget, Zesco go turn nightclub.

  “Make e Continue Like Dis” — Ademola Lookman Body Dey Sweet Am as Atletico Madrid Silence Barcelona for Camp Nou
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 21, 2025 2:25 pm by Hitvibz Media