Chiwendu Ihezuo wey carry Super Falcons waka go win WAFCON 2024 don show say her boot no dey cool at all.

Pachuca Women dey celebrate big Concacaf Champions Cup victory

Babe just waka enter field from bench come burst net again, ginger her Pachuca side make dem flog Chorrillo FC like say na training match. Concacaf Champions Cup don turn cruise for her, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Chiwendu Ihezuo Help Em Team Run Am Like Say Dem Be Barca

She play only 45 minutes o, but na enough wahala she cause.

Three shots, one sweet goal, and her team scatter their Panamanian visitors 6-0 for Estadio Hidalgo. Abeg, who wan breathe?

Pachuca forward Ihezuo kuku score for 6-0 win over Chorrillo FC

Ihezuo na sharp babe. Na back-to-back goals she dey serve now. She score against Tigres UANL last match wey end 3-2, come repeat am again sharp-sharp here.

  Chinwendu Ihezuo Show Power from Bench, Score Third Goal as Pachuca No Dey Lose for Clausura

Two goals in four matches, abeg that form no be beans.

From kickoff, Pachuca no dey smile. Jocelyn Orejel break table with early goal at 19th minute.

Before Chorrillo fit shout “ref!”, Natalia Mauleón double am three minutes later after Myra Delgadillo scatter their defense like Agege bread.

After halftime, Charlyn Corral pack go bench, dem bring Ihezuo, na there wahala fully start.

Paola García knock third goal at 52nd minute, Delgadillo still dey pull strings like prime Iniesta.

  Super Falcons Babe Chinwendu Ihezuo Knack Early Goal, Make Pachuca Waka Pass Queretaro

Then Ihezuo enter the chat — bam! Fourth goal. No delay, no dulling.

As if e no do, Nina Nicosia come collect mic for last minutes, score two goals back-to-back at 83rd and 86th.

Chiwendu Ihezuo dey celebrate goal for Pachuca in Concacaf Champions Cup

At that point, Chorrillo defenders just dey look clock dey beg for final whistle.

Na Warning Shot Be This O!

Pachuca dey vex. Ihezuo and her crew dey play like hungry lions wey never chop since morning.

From keeper reach striker, everybody dey shine teeth. That 6-0 na warning shot for Group A people — dem suppose dey fear now.

Nigerian striker Chiwendu Ihezuo dey shine in Concacaf Champions Cup match

Next stop? Liga MX Femenil Apertura. Pachuca go jam Atlas Women. With Ihezuo dey hot like pepper soup and confidence high like Benzema for Madrid days, Atlas fit collect their own share of gbege.

  Osinachi Ohale knack late winner as Pachuca survive the comeback wey León try pull
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 21, 2025 9:10 am by Hitvibz Media