Super Falcons star Blessing Nkor don start life well for Belarusian Women’s Premier League. She score for her first match to help Dynamo Brest Women wire Belarus U19 Women correct 8-0.

Blessing Nkor celebrates debut goal for Dynamo Brest

Nkor enter from bench come finish the work as Dynamo Brest pour eight goals wey no get reply inside their opponent net for Regional Sport Complex Brestskiy, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Blessing Nkor score for debut to seal the win

Dem carry her enter for 58th minute to replace Diana Osmolovskaya, and e no take her reach 16 minutes before she show her levels.

The day soft for the Nigerian striker and even the team sef, as dem play their first home match for the league with heavy winning.

Dynamo-Brest players play their first home match for this 2026/27 season with better result against ABFF U19. To make the matter sweet, fans enter the stadium for free to watch the show.

  Ifeoma Onumonu goal drought don finish: Super Falcons baller tear net, dash Montpellier ginger for big win

Na goal-fest from start to finish as Dynamo Brest Women format Belarus U19 Women 8-0.

Nalugia Shamirah start the fire for 10th minute, and from there, goals just dey drop like rain. Kseniya Yatsynovich and Marharyta Yurchuk nack their own before half-time to show say no hope for the other team.

  Motunrayo Ezekiel fire late as Racing Power waste advantage against Valadares wey chop red

Nkor ginger the team for perfect start

After half-time, Brest just turn the match to training. Alena Guseva score the fourth goal before Milena Nikitina carry light join the matter as she score two quick goals.

Arina Smirnova add the seventh one, and our own Nkor come use the eighth goal take seal the deal for 74th minute—she don arrive with style!

With this win, Nkor and her teammates don win two matches out of two. Dem get six points, nine goals, and nobody don fit score dem yet.

E never reach two weeks wey Nkor sign for Brest. The 22-year-old winger sign contract wey go keep her for the Belarusian club till the season finish.

  Super Falcons Babe Chinwendu Ihezuo Knack Early Goal, Make Pachuca Waka Pass Queretaro
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 24, 2026 7:43 am by Hitvibz Media