Super Falcons baller Esther Okoronkwo don waka go collect the 2025 Northern Super League (NSL) Assist Leader award, after she turn AFC Toronto to correct title machine wey win their first regular-season crown.

Esther Okoronkwo wins Assist Leader award in NSL

This babe creativity na premium. Final-third wey tight? She go just tear am open. Seven assists. Number one for the league. Case closed, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Esther Okoronkwo: Toronto Title Engine, Assist No Be Her Mate

At first, we dey reason say wetin dey sup — eight matches and no assist. But once she burst pipe for that 3–2 away win against Vancouver Rise, everywhere scatter. From there, na cruise control.

  Super Falcons Star Francisca Ordega Shine from Bench as Al-Ittihad Commot Saudi Women’s Cup

Next match, she still drop another sweet pass as Toronto knack Calgary Wild FC 2–1. Before Halifax Tides fit shout “mark am!”, she don serve assist, score goal, and help run them 3–1. Hot streak wey dey pepper defenders anyhow.

Esther Okoronkwo NSL Assist Leader celebration

Small break land because national call-up enter — 2024 WAFCON for Morocco. She follow Super Falcons go collect our record 10th continental trophy, plus she drop six assists there. She too sabi.abeg.

As she land back for Canada, she no even warm engine — straight assist inside 2–1 win against Montreal Roses FC. Toronto title chase just dey gallop like okada wey no get brake.

AFC Toronto Big-Match Specialist — Assist Queen With Steeze

Esther Okoronkwo AFC Toronto 2025 season

Her assist number five land against Vancouver Rise again — and as if e no do, she score two inside their 7–0 demolition. Vancouver go still dey see her for dream.

  The Year Wey Esther Okoronkwo Burst Brain Finish — But CAF Still No Carry Am Enter Final Top 3

Number six? Against Ottawa Rapid. Narrow 1–0 win — na her assist seal am.

Number seven? Again na Montreal Roses wey collect 2–1. Woman no dey drop pass for small matches — na big moment specialist.

No be assist alone she get o. For 20 matches, she rack up eight goals, making 15 goal contributions. She carry Toronto on her shoulder like Ghana-Must-Go. Confidence? Check. Swagger? Double check. Title? Confirmed.

Esther Okoronkwo claims NSL Assist Leader award to cap historic Toronto run

Now, our 28-year-old queen dey carry the same hot form go meet Super Falcons again as we prepare face Benin Republic for the 2026 WAFCON Qualifiers on October 24 and 28.

  Naija Babe Ashanti Akpan Don Finish 12-Year Journey for Chelsea, Come Join Newcastle United
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on October 22, 2025 5:53 pm by Hitvibz Media