Na so Super Falcons of Nigeria don hammer their way enter final for WAFCON 2024, afta dem manage squeeze small win over Banyana Banyana of South Africa.

WAFCON 2024: Super Falcons manage escape Banyana Banyana, land for final

Dem enter the match with gbege confidence, especially afta dem scatter Zambia 5-0 for quarterfinal, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Na Ajibade first open fire as Super Falcons carry early lead

But as match start, na South Africa hold ground pass.

Dem just hold Falcons for neck until 44th minute, when Rasheedat Ajibade — wey sabi knack goal against Banyana — come do her usual magic from penalty.

Rasheedat Ajibade

Na she be captain, she waka go front, jam the ball wella enter net. Nigeria carry that one-goal lead enter halftime.

  Jennifer Echegini chop assist as PSG Women survive late pressure come beat Nantes

Omo, that na her third goal against dem Banyana babes o!

Second half never too far go, na so wahala start. 13 minutes in, South Africa come get their own penalty.

Dhlamini dey run enter box dey chase one through ball, but Osinachi Ohale hold her shirt — ref no waste time, point penalty spot sharp-sharp.

 

Na Linda Motlhalo jam am enter net. 1-1. Zaouli Stadium burst!

  Tolu Arokodare Don Finally Blow! 'My Super Eagles Call-Up No Be Luck—I Don Win Already'

Naija don run am again – dis time na for WAFCON

Alozie last-minute thunderbolt carry Falcons enter final level

But wahala no end there. As match wan end, Michelle Alozie say she no dey go extra time.

She just send one looooong ball forward, somehow e find net! 2-1 for Super Falcons! Na stoppage-time drama be that!

With that win, Naija don pursue the title holders comot for road and their “Mission X” still dey on track.

Last year (2024), na Super Eagles nack South Africa enter AFCON final. Now for 2025, na Super Falcons do dem again enter WAFCON final.

  CBN direct banks to create mobile apps to update customers of fx movement

As e be like this, Nigeria sabi handle business when e choke pass!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 22, 2025 9:18 pm by Hitvibz Media