The Super Falcons of Nigeria truly show who be boss on Monday as dem wire Senegal 3-0 proper for dia friendly game.
This massive win mean say dem don beat dem back-to-back for the two friendly match wey dem play to prepare for the 2026 Wafcon. No forget say Nigeria bin first win dem 2-1 for the first match, na weytin hitvibz yan be dat
Super Falcons Wire Senegal Proper for Friendly Match
The first half tough die as the two teams dey find goal, and the match just dey row-row go scoreless before half-time.
Nigeria nearly score when Joy Omewa wire one heavy shot hit the right post, after Rasheedat Ajibade give am one sweet pass.
Even though Falcons dey press, Senegal defence strong small and dem base on counter-attack to disturb Nigeria.
But things change quickly as second half start. Our girls double their hand, and for the 48th minute, Omewa use head arrange the first goal inside net after Shukurat Oladipo loss one correct cross give am.
Just eight minutes after, the same Omewa pick spot finish cleanly to score her second goal, wey put Nigeria for correct standard.
Ajibade Show Skill As Oshoala Seal The Back-to-Back Win
As Senegal players just dey look face, Ajibade continue to distribute dirty passes for midfield.
The coach come change face, he comot the goal-scorer Omewa bring in star girl Asisat Oshoala, and Esther Ijamilusi enter for Francisca Ordega.
The change work sharp-sharp for the 66th minute. Oshoala just cool down convert another wicked assist from Ajibade to make the score 3-0.
This sweet performance confirm say Super Falcons na Baba as dem win Senegal back-to-back for the two friendly match.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on June 8, 2026 7:17 pm by Hitvibz Media



Stay connected