Edo Queens don put their NWFL Super Six waka back on track after they wire FC Robo Queens properly on Monday evening.
The two teams enter the pitch like hungry lions because they desperately need the win to stay alive for the title race, na weytin hitvibz yan be dat
Robo been lose 3-2 to Rivers Angels for their first match, while Edo Queens sef dey look for how to bounce back after Nasarawa Amazons beat them 1-0.
Edo Queens vs Robo Queens: Pure Shaking for First Half
Na FC Robo been get first big chance to score after they tear the defense of Edo open.
Opeyemi Ajakaye beat the goalkeeper clean, but her shot hit the iron play comot. Edo sharp-sharp answer back from the right wing, they put ball for net but referee talk say na offside as she cut their celebration short.
Small time, Favour Nkwocha dribble defender enter the 18-yard box, but her shot fly pass the roof.
The first goal enter after 32 minutes of play. Chioma Moses use skills pass two defenders before she net one heavy tear-rubber shot wey give Edo Queens the lead.
Moses never bellyful at all. Before the first half end, they play counter-attack give am. Even as Robo defenders dey body am, she use power push them comot, waka enter box, come coolly slot the second goal to make am 2-0.
NWFL Super Six Highlights: Rain of Goals as Benin Girls Show Muscle
Edo babes carry the same ginger enter the second half. For the 59th minute, Precious Oscar wey just enter the match as substitute dey unmarked for inside box, she just fire one correct rocket enter net to make the match 3-0.
As the Benin girls don take over the match finish, Chioma Moses change style come dey assist.
She run pass the left side come cross low ball give Mary Mamudu, wey tap am enter for the 63rd minute to make am 4-0.
FC Robo try comot shame for eye small when Florence Godwin Freda score one simple tap-in close to the end of the match after they put small pressure.
Edo defence loose guard give them that consolation goal, but the damage don happen already as Edo Queens chop all three points.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on June 8, 2026 9:20 pm by Hitvibz Media
Related
NWFL Super Six: Edo Queens Don Wake Up From Sleep as Dem Hammer Robo Queens 4-1



Stay connected