Gombe United don get new team bus—at least na wetin state government wan make everybody believe.

Gombe United Receives New Bus—Can it Transport Them Back to NPFL

Dem present the newly branded coaster bus give the club through Deputy Governor, Dr Manasseh Daniel Jatau, on behalf of Governor Muhammadu Inuwa Yahaya.

Government hope say the bus go reduce the team travel wahala and help push dem back go top-flight football, na weytin hitvibz dey yan be dat.

But Abeg, This Bus Fit Wake Gombe United Again?

No be say dem no appreciate the gesture, but if you look am well, the bus dey look more like refurbished motor than brand-new one.

Gombe United in Nigeria National League match

Make we yarn true, Gombe United problem no be comfort for road alone.

  Ex-NPFL star Echeta Deputy score again for third match straight, drop brace carry Zakho climb Iraq Stars League table

For 2023/24 NPFL season, na dem be the first team wey relegate—four matches still remain. Since that time, the club never really recover.

Na dem fourth relegation since year 2000, meaning say dem don join list of teams wey dem dey relegate anyhow. Only Kwara United (6 times), Wikki Tourists (5 times) and Jigawa Golden Stars don fall pass dem.

From NPFL to NNL: Na Long Journey Be Dat oh!

As dem dey now for Nigeria National League (NNL), Savannah Scorpions no dey impress anybody for Conference D.

Gombe United seeking NPFL promotion

After six matches this season, dem dey 7th position with just seven points—nine points behind group leaders, Ranchers Bees FC.

Their record na two wins, one draw and three losses. So question remain: this new bus fit really ginger dem to start winning?

  NPFL Matchday 22: Rangers scatter everywhere, Enyimba fall hand as relegation wahala choke Pillars

Governor Yahaya administration talk say the bus na part of bigger plan to support the team.

For the presentation, Dr Manasseh advise the players make dem dey careful when dem dey travel, and avoid night journey. If journey long, make dem break am.

Club General Manager, Anas Bamusa, thank the governor and promise say the club go try pay back the support with better performance, so dem fit bring back the pride of Gombe people.

Gombe United new team bus presentation

Whether this bus go really carry Gombe Scorpions back to NPFL—or just make dem dey travel better for another hard NNL season—we go still dey watch.

  Super Eagles Oga Chelle wan carry fresh blood join team, promise say NPFL stars go show for Unity Cup

But one thing clear pass: na more than new motor Gombe United need if dem wan regain their old glory.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 7, 2026 11:50 am by Hitvibz Media