My people, make una hear tori. Esther Okoronkwo don turn AFC Toronto to firewood for attack as she knack hat-trick wey burst Montreal Roses FC head for snow-covered York Lions Stadium.

Super Falcons forward Esther Okoronkwo scores for AFC Toronto

Babe no dey joke — she drop three goals inside first 20 minutes, before dem even sabi say match don start. Toronto win 4–1 sharp-sharp, enter Northern Super League final like boss, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Esther Okoronkwo’s Hat-Trick – The Real Wahala for Montreal

See ehn, this Okoronkwo matter don turn Montreal to her personal customers. Toronto don win the first leg 2–0 for Montreal, so with this latest 4–1, na 6–1 total. E no even get suspense.

From kickoff, you fit see say Esther mean business. Seven minutes in, she just waka into box like landlord collect rent — easy tap-in after Kaylee Hunter serve her better assist.

Esther Okoronkwo celebrates hat-trick for AFC Toronto in NSL semifinal

Before Montreal fit recover, na 21st minute don show. This time, she bend one free kick from wahala angle wey make keeper freeze like person wey see NEPA bill. Goal sweet die.

  Journey Number 10: How Super Falcons & Rivers Angels Follow Same Road Win Cup – Mission X

But na the third goal make everybody shout “Wetin we dey watch here?!” She try pass, defender block am, ball bounce back.

As e return, Esther just vex — dribble four defenders like say na traffic she dey beat for Lagos, slot am calmly. Hat-trick complete. Stadium scatter.

Toronto still add one more as Lauren Rowe finish the work for 84th minute. Montreal manage one consolation through Tanya Boychuk, but by then e don be.

Toronto Dey Chase Glory – Okoronkwo Carry Them for Back

Now Toronto don dey look final like hungry man dey look suya. Dem go jam Vancouver Rise for BMO Field this Saturday. Vancouver sef no easy — dem survive Ottawa 5–4 for penalties after 3–3 draw.

  Uchenna Kanu Scatter Net with 34-Minute Hat-Trick as Cruz Azul Beat Atlas 6–4

Esther Okoronkwo Fire AFC Toronto enter NSL Final with better First-Half Hat-Trick

Funny enough, this second leg no even suppose hold that day. Snow wan cancel am, but Okoronkwo no send. Cold no fit cool her blood at all — she still hot like generator exhaust.

Na so the Super Falcons striker take carry her season total to 11 goals, after scoring eight plus eight assists for regular season.

29 goals plus assists for 30 matches for club and country for 2025 — no African player don reach am.

Babe dey operate like say she get personal beef with Montreal — five times dem don meet, she don score four, assist three, lose zero. Na proper “customer dazed.”

Africa’s Queen Still Dey Reign

Forget club level, this girl dey rep Naija steady. CAF don shortlist her for Women’s Player of the Year award, alongside her Super Falcons sister Rasheedat Ajibade.

  Jennifer Echegini Don Score Her First UWCL Goal for PSG as Rinsola Babajide Dey Flex for Roma

Esther Okoronkwo leads AFC Toronto to Northern Super League Final

If she continue like this, by 2026, dem go dey mention her name with legend voice. Esther Okoronkwo no just dey play ball — she dey preach football gospel with goals.

Abeg, make Montreal rest small. Next time dem hear “Toronto,” dem go first check whether Esther dey squad before dem even wear boot.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 11, 2025 1:24 pm by Hitvibz Media