Our very own Odogwu midfielder, John Mikel Obi, don send serious warning give Super Eagles just before their do-or-die World Cup playoff match against Gabon this Thursday.

Mikel Obi don talk to Super Eagles players for Gabon matter

For him Obi One Podcast, di Chelsea legend talk say this Gabon match na like JAMB—you fail am, na to rewrite be that. The former Eagles captain no even smile when em talk am, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Mikel Obi tell Super Eagles: “No Sleep On Top Gabon Matter”

The first game na the most important one. No dey look Gabon like small pikin o, because if we mess up, wahala go wear boot.”

He come add,

Enter that match like say na the last game wey you go ever play for your life. Beat Gabon first, before you dey think of Cameroon or anybody wey wan show.”

You fit feel say Mikel still get that discipline wey make am collect plenty medals for Chelsea. The guy just dey hammer commitment like say na semovita.

“No Dey Do Like Say Na Just Gabon”

Mikel warn say if Super Eagles begin do shakara because dem feel say Gabon no strong, e fit end in premium tears.

  Ademola Lookman Don Become Atlético Madrid Player After Europa League Big Show

The biggest mistake na to think say na just Gabon. Once we think like that, we don finish,” the guy yarn.

Na true talk. Football no dey respect name again — you fit ask Argentina after that Saudi Arabia wahala for Qatar.

Super Eagles players in Training.webp ahesd of Nigeria vs Gabon clash

“Remember Say Na Green White Green You Dey Represent”

Mikel come still ginger the boys make dem play with heart, chest, and small madness.

Go there play with confidence and passion. That jersey wey you dey wear no be Ankara, na pride of the whole nation,” he talk.

He remind them say when you wear Super Eagles shirt, e no be fashion parade — e mean say 300 million Nigerians don hand you their hope like bag of garri during scarcity.

  Ola Aina supply one, Awoniyi finish work as Super Eagles boys fire Forest pass Brentford

“Pressure Full, But E No Go Kill Person”

Even though Mikel gree say the pressure no be beans, he still talk say he believe the boys go deliver.

300 million people dey watch, na serious pressure, but na wetin big players dey chop like breakfast. I believe say dem fit do am,” he add.

“Eagles Don Begin Warm Up for Morocco”

Meanwhile, our boys don land for Rabat, Morocco, since Monday. Dem don already begin training for Rive Hotel training ground — and the vibes for camp dey sweet like jollof with suya.

If Super Eagles knack Gabon wella, dem go waka go the final playoff round, where DR Congo or Cameroon fit show face.

  Samuel Chukwueze Don Go Assist Winner as Fulham Jump Go 14th for Premier League

The winner go secure that golden ticket go the 2026 World Cup — wey dey America, Mexico, and Canada.

Nigeria vs Gabon: Super Eagles players in Training

Na now we go see who get lion heart and who just dey post gym video for Instagram.

Abeg Super Eagles, no use dis match do experiment o — make Gabon no turn our own Madagascar story part two.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 11, 2025 9:10 am by Hitvibz Media