My people, una don hear? Na so our own Victor Osimhen finally open him goal account for Galatasaray! The guy wey dem carry from Napoli don knack him first goal for Turkey. Omo, e sweet like suya with cold beer.

Osimhen amd Galatasaray dey celebrate 4-0 win over Kayserispor

Osimhen miss first match, second one e no see net. But third time na charm. You know say even Messi dey get off-day.

Ronaldo sef don blank before. So Osimhen just dey warm engine, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Osimhen Burst Net Against Kayserispor

Sunday evening, Galatasaray waka go RHG Enerturk Enerji Stadium. Bros, dem no even sweat. Na 4–0 dem carry commot. Dem treat dia opponents like training session.

Victor Osimhen don score em first Galatasaray goal vs Kayserispor

Na 36th minute Evren Eren Elmali first tear net. If to say na EPL now, commentators for don shout like say person win lottery.

  Victor Osimhen Try Well Well but Napoli Still Chop Disappointing Defeat from Bologna

Second half never start finish, na the same Elmali double the matter. Leroy Sané cook the assist like mama put rice with correct stew.

Kayserispor try fight back, but omo Gala just dey run am like Barcelona of old. Pace, precision, everything package.

Then 86th minute, boom! Osimhen finally nack him own. Nicolo Zaniolo give am delivery wey sweet pass chilled palmwine. Osimhen no dull, just slot am home.

  Cyriel Dessers Na Em Run Show As Rangers Scatter Viktoria Plzeň For UCL Qualifiers

Galatasaray players don dominate Kayserispor in away clash

As injury time dey finish, Sané decide say him sef no go gree left behind. Guy tear net, Berkan Kutlu serve the assist hot-hot.

Gala Make Statement, Osimhen Shine

Four goals, three different scorers, clean sheet on top. Na so you go know say dem no dey joke. This na statement win. Istanbul giants just talk say “we dey here, no play with us.”

Osimhen and Galatasaray don win Kayserispor 4-0

But omo, make we no lie, Osimhen first goal na the real headline. Nigerians don dey wait since.

Na like striker wey finally score after 10 blind dates. The whole beer parlour just erupt!

If Osimhen continue like this, defenders for Turkey go dey sleep with one eye open. E go be like marking prime Drogba wey drink ogogoro.

  Victor Osimhen correct assist scatter Liverpool as Galatasaray chop narrow win for Champions League
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 24, 2025 10:46 pm by Hitvibz Media