Victor Osimhen don tell im Galatasaray team-mates say make dem no let dia head fall, make dem still focus on the league title even though Samsunspor give dem 4-1 beating for Turkish Super Lig.

Galatasaray vs Samsunspor 4-1 defeat match action

The Super Eagles striker no find am easy for the match, but he still stand gidigba say the club go finish the work and carry the trophy, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Osimhen still focus despite Galatasaray palava

The Nigerian boy start the match with ginger, he give Yunus Akgün assist for the first goal when match never even reach nine minutes.

That time, e be like say Galatasaray don set, but things change sharp-sharp as Samsunspor start to fire back.

The striker night come spoil for second half when one back pass wey he play miss road. That mistake lead to serious wahala wey make referee pursue dia goalkeeper, Günay Güvenç, commot for pitch.

  Tochukwu Nnadi don land for Marseille after AFCON shine, Jimoh-Aloba return to West Brom

Samsunspor celebration after goal against Galatasaray

From that point, Galatasaray legs come dey shake, dem no fit recover till the game finish.

Even though the beating heavy, Victor Osimhen say make dem no let the result finish dia morale for the season.

Make we no stay for this game. We gats move forward,” na so Victor tell Fotomac.

Osimhen send strong message for Galatasaray title race

The 27-year-old forward make am clear say dia eye still dey the main prize — to win the league. He talk say one bad result no suppose spoil all the work wey dem don dey do since.

  Kelechi Iheanacho don finally find em groove with brace for Sevilla

We need to win for home and announce say we be champions. Nothing change. The team go give everything. We go focus on the next match.”

Osimhen gree say the team no try for the match and he no hide as he take responsibility join im team-mates.

Victor Osimhen assist for Galatasaray vs Samsunspor

We know say e no go easy to win the title for here. We no play well at all. We go win our next match for home and collect the championship officially. We beg the fans make dem no vex. We go look forward,” na so he add join.

Even with this wahala, Osimhen record for this season still brain-box.

  Super Eagles ballers Philip Otele and Olakunle Olusegun chop red card for Europe

The naija baller don score 20 goals and give eight assists for 32 matches across all competitions, wey show say he be oga for Galatasaray title struggle.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 3, 2026 6:18 am by Hitvibz Media