Super Eagles of Nigeria show say dem no come joke on Friday afternoon, as dem wipe Iran 2-1 inside international friendly match wey hold for Mardan Sports Complex for Antalya, Turkey.
Na goals from Moses Simon and Akor Adams give Nigeria wetin dem need to carry the day, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Iran vs Nigeria Friendly: Simon Open Score Early
E no take Nigeria pass six minutes to show say dem be the real Ogas. Moses Simon na him first draw blood, as he use one correct tear-rubber shot from outside the eighteen-yard box put Nigeria ahead.
After he shake body pass the defender wey dey mark am, the forward just wire the ball enter bottom-left corner. That early goal na him make Eagles carry the 1-0 lead go break.
Super Eagles start the second half with fire for body, but Akor Adams miss one clear chance to make am 2-0 after Samuel Chukwueze give am fine pass.
But the Sevilla star quick-quick correct him mistake. Small time after that miss, he calm down finish the beta assist wey Ademola Lookman give am to make the score 2-0.
Iran come pull one goal back for 67 minutes through Mehdi Taremi—and na their first ever goal be that against the three-time AFCON champions.
Even though Iran put pressure for die-minute, Nigeria hold their ground win the match.
Wetin We Learn From Super Eagles vs Iran Match
Clinical Finishing: Goals from Moses Simon and Akor Adams secure the win.
Creative Playmaking: Chukwueze and Lookman both give assists.
New Faces: Emmanuel Fernandez play him first match for Super Eagles as he enter for Semi Ajayi after half-time.
Chibuike Nwaiwu self get him first cap as he replace Igoh Ogbu for the 57th minute.
Head-to-Head Record: Nigeria don win two out of their last three matches against Iran, and the other one end for draw.
Looking Ahead
As Nigeria dey use this game rebuild, test new tactics, and bring in fresh blood after the World Cup qualification wahala wey happen before, the match help Iran prepare well for the 2026 World Cup.
With this sweet win, Super Eagles don shift their eyes go the next match against Jordan on Tuesday.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on March 27, 2026 7:37 pm by Hitvibz Media



Stay connected