Alex Iwobi reach historic Premier League milestone for Saturday, even as Fulham chop correct 2–1 beating for Newcastle United hands and na for inside St. James’ Park.
The Super Eagles midfielder don turn the first Nigerian wey don play 300 Premier League matches — e just use style write im name inside English football history book, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Alex Iwobi don collect 300 Premier League game
Iwobi play full 90 minutes before dem commot am late, and the guy no dull at all — energy, vibes, ginger, everything full ground.
He register 51 touches, 44 passes, two crosses and two shots on goal. But still, na Fulham come waka comot empty-handed as Bruno Guimarães fire late winner wey scatter their hard work. Marco Silva and im boys believe say dem deserve better, but ball no be by grammar.
Before the match sef, the 29-year-old don already pass Shola Ameobi record as the Nigerian with the highest Premier League appearances.
Now with 300 games, Iwobi don join elite African table — Kolo Touré, Mohamed Salah, Jordan Ayew and Wilfried Zaha. Na only five of dem for the whole continent get that level. Correct company.
Iwobi come begin reason em milestone after di historic night
Even though dem lose, Alex Iwobi still raise shoulders small — guy proud, but e pain am.
“Na big honour to lead this thing, especially as Shola Ameobi and even my uncle (Jay-Jay Okocha) don play Premier League,” he talk. “But I never done. I go continue dey push and protect the record.”
Em Premier League journey wey em build wit em sweat
Born for Lagos, grow for Arsenal academy, Iwobi make im Premier League debut in 2015 under Arsène Wenger.
After four seasons with the Gunners, Everton sign am in 2019, and the fans begin love him because of im hustle and versatility. In 2023, Fulham carry am, and since then, the guy don level up im game.
This 300 milestone no be fluke — na pattern. For 2024, he pass John Obi Mikel for most Premier League minutes by any Nigerian.
Earlier this year, he also become the first African to play 50 Premier League games for three different clubs. Heavy record.
But after the Newcastle heart-break, Iwobi talk say focus don shift back to better results for league table.
Iwobi no hide am — that last-minute goal pain like break-up text. He explain say Fulham come out with more fire for second half, use the wings well and create plenty openings.
“Omo, e pain us no be small,” Iwobi yarn Fulhamfc.com. “We sabi say the match no go easy and this stadium no be child’s play. But if we no fit win, at least make we hold the draw — we no suppose lose at all.”
But for ball, if you no bury your chances, big teams like Newcastle go show you shege.
Defeat at St James' Park. pic.twitter.com/C0KiXG3JEt
— Fulham Football Club (@FulhamFC) October 25, 2025
He add say Fulham actually limit Newcastle for large part of the game, but small small mistakes cost dem.
To survive, he talk say the secret na simple: stay consistent, give 100 per cent, and maintain focus till final whistle.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on October 26, 2025 8:13 am by Hitvibz Media



Stay connected