Rivers United show correct spirit for Uyo as dem flog Black Bulls 3–1 for their CAF Champions League second-leg showdown for Godswill Akpabio Stadium, clear road enter group stage of Africa biggest club competition.

Rivers United thrash Black Bulls 3-1 in Uyo

Match wey suppose happen Sunday shift go Saturday because Davido wan shutdown the stadium for concert — and as e be, na Rivers United the change favour, as dem land Uyo with new ginger after dem lose first leg 1–0 for Maputo, na weytin hitvibz yan be dat

Rivers United Take Charge for CAF Champions League Wahala

After Remo Stars chop 5–1 disgrace from Mamelodi Sundowns, na Rivers United carry Nigeria hope for pocket enter this fight like Avengers of NPFL.

  Rivers United goalie Osagie Onisodumeya blast people wey dey criticise Finidi, talk why dem suppose give am time

Rivers United thrash Black Bulls in Uyo

Finidi George boys start the match like men wey no dey smile at all. Just 15 minutes, one wicked free-kick scatter Black Bulls defence, ball bounce anyhow, and Wasiu Falolu no dey dull — GBOSSA! — he smash the ball inside net. 1–0. Stadium vibrate!

Pressure no gree stop. 42nd minute, wahala again. Penalty for Rivers. Maclyn Biokpo waka go spot, no shake, just send keeper go buy Fanta as ball go the other side. 2–0. Halftime. Uyo dey on vibes.

Rivers United 3-1 Black Bulls in Uyo

Zachariah Land Killer Punch as Rivers March Go Group Stage

Second half never even settle, Black Bulls rush commot like people wey forget pot for fire. 47th minute, Moctar Diallo score one sharp goal. Aggregate don balance like PHCN bill — but Rivers boys no panic, no scatter, no lose head.

Rivers United celebriting 3-1 Black Bulls win in Uyo

Garden City giants hold their shape. Hold their swagger. And finally, 76th minute — the moment wey burst champagne — Timothy Zachariah deliver one missile finish. Net shake. Uyo scatter. 3–1 on the night, 3–2 overall. Game over. Lock am. Seal am. Stamp am.

  Stanley Nwabali Fit Land for Rivers United? Super Eagles Legend Don Put Mouth Inside

Na Rivers United biggest win this season and e don carry dem enter CAF Champions League group stage where bigger head and stronger gbas-gbos dey wait.

The journey don start proper.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on October 26, 2025 10:04 am by Hitvibz Media