Rivers United still dey carry road for NPFL as dem beat Bendel Insurance 3–1 for matchday 29 inside Adokiye Amiesimaka Stadium.

Samson Obi and Wisdom Samuel impact in NPFL game

The Pride of Rivers don knack two home wins back-to-back, and Wisdom Samuel na big reason why their attack dey sharp for both matches, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Wisdom Samuel dey shine as Rivers United extend home winning streak

After first half no goal, the home team finally knack first goal for 53rd minute. Chijioke Mbaoma header from correct corner wey Iyowuna Douglas deliver, make Rivers United take lead.

Samuel come add another goal for 81st minute, finish from another Douglas assist.

Bendel Insurance try small as dem score one late goal for 89th minute, but substitute Samson Obi quickly restore the two-goal advantage.

  Kano Pillars chop free ₦2.2m from one correct fan upon their relegation fight

Wisdom Samuel during NPFL match in Port Harcourt

After the match, Samuel talk how e feel play.

Abi I dey very happy. I happy well-well. Today game important like our last one. So we gatz collect full points. I happy say we score. I dey happy die say we win today.”

Confidence high as Pride of Rivers dey chase NPFL glory

Samuel don score three goals for two matches wey dey follow one another, difference from last season wey e mainly dey assist for Heartland FC.

E talk how e important to score for him career.

  “We Don Tire for NPFL” — Kun Khalifat Don Dump Naija League Over ‘Wicked’ Sanctions

“E very, very important. I play all last season; I no score, but I dey give assist. You sabi, for this league, if you no dey score, people no dey notice you. So yes, I dey happy say I score,” e yan.

When dem ask am about Rivers United chance to win title, Samuel faith clear: “Yes, I sure. Na God dey my side.”

Coach Daniel Yemi hugging Wisdom Samuel after scoring foe Rivers United against Bendel Insurance

The striker recent form show say coach dey trust am well. “Na wetin I dey expect. Everything depend on wetin coach talk – anything wey e talk,” e add as e yan about starting games.

With two tough away matches wey dey come against Shooting Stars and Ikorodu City, Rivers United go dey hope say Samuel go continue to dey score make dem hold top for NPFL table.

  Kun Khalifat Baller Nnorom Mmesoma Talk Bold Say “Our Levels Don Change” Before Dem Jam Warri Wolves
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on March 10, 2026 11:12 am by Hitvibz Media