Victor Osimhen don show for news again as e give another assist, but e no reach to save Galatasaray from the heavy 4–1 beating wey Samsunspor give dem.

Super Eagles striker Victor Osimhen in Turkish Super Lig

The Super Eagles striker na em set up the first goal of the match, but em team come fall hand, as dem lose guard come collapse for inside Samsun Yeni 19 Mayis Stadium for their Matchday 32 clash, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Osimhen Assist No Reach as Galatasaray Scatter for Samsunspor Hand

Galatasaray lose this match even though Victor Osimhen still dey show pepper with em fine form. Now, e don get five assists for inside 21 league matches.

The Nigerian striker still get 13 league goals, wey mean say em total goals for the season don reach 20.

If you check all the competitions wey e play, e don score seven goals and one assist for UEFA Champions League. This one mean say e don involve for 26 goals total this season.

  Former Super Eagles boss don collect new head coach job for Saudi First Division League side

But for real, the night rugged for the league leaders. Dem chop four goals and even collect red card join, wey make the whole trip go Samsun bitter die.

The defending champions start the game with ginger and dem score for the 9th minute. Yunus Akgün use sense see say the goalkeeper don commot for line, na so e take cool head finish the ball after Osimhen set am up.

Victor Osimhen assist for Galatasaray vs Samsunspor

Samsunspor no gree, dem come back strong and equalise for the 22nd minute. Na Marius fire one low power shot enter corner after e find space for box.

After half-time, the home team come complete the comeback. For the 57th minute, Cherif Ndiaye wire one fine ball enter top corner after e dribble em marker, na so the score take turn 2–1.

  “Di feeling sweet” — Super Eagles future baller Yira Sor react after dem name am Europe fastest player

Osimhen Assist Give Dem Hope, but Samsunspor Show Dem Shege

Osun go bad for Galatasaray for the 63rd minute when their goalkeeper, Günay Güvenç, collect straight red card. The visitors come remain ten men for pitch.

Samsunspor take style use the advantage since Galatasaray players no reach again. For the 71st minute, Marius score em second goal after Yalçın Kayan give am pass. VAR check am small before dem gree say na goal.

The final hammer land for 82nd minute when Cherif Ndiaye sharp pick one rebound for inside box take score em second goal. Na so dem take confirm the 4–1 win.

Samsunspor celebration after goal against Galatasaray

This result na the heaviest defeat wey Galatasaray don chop for league this season, and na their fourth loss total.

  Paul Onuachu rise like iroko as Trabzonspor lead kpafuka late against Samsunspor

Even with this falling, Osimhen and em team still dey top the table with four points gap, but this loss don put small pressure for their head as the title race dey hot.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 2, 2026 9:31 pm by Hitvibz Media