My people, e don red for Europe oh. Two of our correct No.9s don change address. Victor Boniface pack him boots go Bundesliga side Werder Bremen on loan, while Cyriel Dessers don waka go Greece join Panathinaikos on permanent deal. Naija fans dey shout “Up Super Eagles!” everywhere.
Both of dem dey ginger to scatter net for their new teams this season. Abeg make una dey ready, goals go plenty, na weytin hitvibz yan be dat
Victor Boniface Don Land Bremen to Lead Attack
Omo, na Werder Bremen carry our Victor Boniface. Dem confirm say the deal na loan till 2025/26 season end. Even Fabrizio Romano wey no dey miss transfer gist drop the update — Bremen go even pay part of the guy wages.
After the signing, Boniface no hide him joy:
“The people wey dey in charge convince me well-well. I wan give my best, score goals, help the team reach our target this season. I dey look forward to my new guys for Bremen.”
Head coach Horst Steffen no even dey hide mouth:
“Victor na machine. E strong, e get finishing, e sabi run, e even sabi give assist. For Leverkusen title season, the guy show say he be baller. I dey sure say e go be one of our key men.”
Even Bremen oga for professional football, Peter Niemeyer, join the praise singing:
“We dey happy say we secure Boniface. E don already show him level for Bundesliga, we believe say he go continue am here.”
Na so dem dey talk, but we sef dey wait make Boniface turn defenders to suya.
Cyriel Dessers Begin Fresh Chapter for Greece
As transfer window wan close, Cyriel Dessers sharply sign three-year contract with Greek big boys Panathinaikos. Rangers come drop official statement:
“Yes oh, Cyriel don move go Panathinaikos. The guy score 52 goals for us, play over 100 matches, win League Cup, be top scorer for SPFL, even carry Sam English Bowl. We thank am and wish am better future.”
Sharp striker no get time to rest. As e sign finish, na straight to Super Eagles duty. Na Uyo e go land as Naija dey prepare for World Cup qualifiers.
First Rwanda on September 6, then South Africa three days later for Bloemfontein.
Make we no forget, na Dessers help Super Eagles lift Unity Cup for May when we knack Jamaica for penalty shootout. The guy dey hot, e just need steady supply ball make e fire.
Na so e be. Boniface go dey terrorize Bundesliga keepers, Dessers go dey chop Greek defenders like shawarma. Naija strikers dey rep us wella. Super Eagles fans, una ready?
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on September 2, 2025 8:35 am by Hitvibz Media


Stay connected