Omo, transfer deadline day no dull at all. Premier League clubs shake market last minute. Fulham carry Samuel Chukwueze from AC Milan on loan, while Crystal Palace sharply grab Christantus Uche from Getafe.

Samuel Chukwueze Fulham unveiling after AC Milan loan

Two Super Eagles land for London. Fans don already dey dream goals, skills, and ginger. Naija no dey carry last!

Fulham Secure Samuel Chukwueze Loan — “Starboy 19” Don Enter Town

Fulham no hide am: “We dey happy to welcome Samuel Chukwueze from AC Milan.”

The deal na season-long loan, with option to buy. Chukwueze go rock jersey No.19. Meaning? Defenders go dey see fire from both wings.

Samuel Chukwueze joins Fulham on loan

He don join him Naija brothers Alex Iwobi and Calvin Bassey for Fulham dressing room — na proper Super Eagles reunion be that.

Everybody sabi wetin Chukwueze fit do. Pace wey dey make defenders twist waist, dribble wey dey scatter marking.

From Diamond Academy to Villarreal in 2017, he don carry Europa League in 2021, reach Champions League semi-final in 2022, before Milan drop €28m carry am enter Serie A.

  Wounded Alex Iwobi Still Enter History — Becomes 5th African to Reach Premier League Milestone

For Italy, the boy show say he no dey fear stage. He knack memorable UCL winner against Newcastle for St. James’ Park.

Last season, he even play Coppa Italia final. Now he dey come Fulham with 46 Nigeria caps and 7 goals inside bag. My guy no be small pikin oh — e be confirmed baller.

London defenders better shine their eyes. Because once Chukwueze turn on turbo, na “hold your jersey, no shame your family” level.

Crystal Palace Add Christantus Uche — “New Eagle Don Land”

Palace sef no gree dull. The FA Cup holders carry Christantus Uche from Getafe on one-year loan.

  Samuel Chukwueze Don Go Assist Winner as Fulham Jump Go 14th for Premier League

The boy don grab No.12 shirt. Chairman Steve Parish dey beam face: “Exciting young talent, full international, welcome Christantus.”

Christantus Uche Crystal Palace signing from Getafe

Make una no forget say Uche climb ladder fast for Spain. From Moralo CP in 2022, to Ceuta, then Getafe. For Getafe, e play 38 matches, chop 4 goals, dash 7 assists. No be bad numbers at all.

The boy sef still dey catch him breath: “This moment na dream come true. Palace na big opportunity for me.”

He go join summer new boys Walter Benítez, Borna Sosa, Yeremy Pino, and Jaydee Canvot. With Uche inside squad, Selhurst Park don get fresh Naija pepper.

Palace fans, una better ready. Because if Uche hit form, defenders go dey hear “how market?” every weekend.

  Samuel Chukwueze Give Second Assist, Help Fulham Knock Tottenham, Shine as MOTM

Naija dey scatter Europe anyhow. Chukwueze go dey turn Craven Cottage to speed lane. Uche go dey give Eagles fresh wings. London sef no go remain the same again.

Super Eagles fans, abeg, make una buy cold beer and popcorn — the season go sweet like jollof.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on September 2, 2025 8:27 am by Hitvibz Media