My people, dis summer transfer window hot like suya for charcoal again o! Two Naija boys Bamidele Yusuf and Elijah Odede don pack their bag enter new club, and na correct upgrade we dey talk.

Estac Troyes Snatch Nigerian Gem Elijah Odede~2

Hungarian champions Ferencváros don sign Yusuf on top four-year deal. Meanwhile, French side Estac Troyes don sharply grab small but dangerous 18-year-old striker Odede, na weytin hitvibz yan be dat

Both players dey carry beta form, plenty wahala for defenders, and serious expectation wey go follow dem new season.

Bamidele Yusuf Land for Ferencváros to Ginger Attack

Omo, Ferencváros no dey play at all. Dem don carry Yusuf waka from Serbian club FK Vojvodina. This guy na baller wey dey shine last season like PHCN bulb. 18 goals plus four assists – na so him tear net anyhow across competitions.

Ferencváros Land Bamidele Yusuf

This season sef, before him waka, Yusuf don already drop 3 goals for just 5 matches. No be beans o. Among Naija players wey dey Europe, this guy dey inside top goal-machines list.

  Anas Yusuf: Nasarawa United all-time top scorer yarn say, “For my next life, na Solid Miners I go still play for"

Coach Robbie Keane no even hide am:

Yusuf na player wey we dey eye since. Him get speed, hunger, and small craze – exactly wetin we need for Europa League.”

Bamidele sef no dull. At him unveiling, him yarn:

I thank Vojvodina for everything. This move na big step. I sabi wetin dey expected, and I go give am full groundnut, no half measure.”

Later, na Instagram him carry ginger fans:

“I dey happy to join dis club! Make una show for stadium. God pass everybody.”

Ferencváros signs Bamidele Yusuf

Vojvodina sef drop farewell like pesin wey dey wave better tenant:

Thank you for your fight and good vibes. Go shine for your career. We wish you success.”

Estac Troyes Carry Small but Deadly Elijah Odede

As Ferencváros dey celebrate Bamidele Yusuf, Estac Troyes no gree dull. Dem don lock 18-year-old striker Elijah Odede with 5-year contract till 2030.

  Emeka Eze, Akanbi Lead Goal Cruise as 8 Other Naija Ballers Scatter Pitch Abroad

Elijah Odede joins Estac Troyes~2

The boy na product of Castle Football Academy for Naija before him waka Sheriff Tiraspol for Moldova.

Na there him first show small pepper – 2 goals, 3 assists last season. But this year, omo, the boy don dey scatter net with 7 goals since June, including 3 for Europe.

Odede fit small, but him leg dey hot. Speedy, dribbler, and sharp in front of post – defenders go soon dey call am “wahala boy.”

Troyes yarn say dem carry am because:

Him na 18, young and raw.

Him dey run like Keke wey no wan stop.

Him sabi bury ball for net without long story.

Na talent wey fit blow proper for Ligue 2 and beyond.

Omo, Naija no dey carry last at all. One side, Yusuf dey go shake Europa League net; the other side, Elijah dey warm up to torment defenders for France.

  Bamidele Yusuf finally burst net for league as Ferencváros run Kisvárda street for NB 1 showdown

Estac Troyes signs Elijah Odede~2

Na only time go show which one go turn big baller like Osimhen or even pass am.

If Yusuf and Odede fit carry their shooting boot go Europe, defenders go dey beg referee make dem blow final whistle sharp-sharp.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on September 2, 2025 3:35 pm by Hitvibz Media