Na so Naija baller Tenton Yenne show himsef for Russia sharp sharp, as him score for him first Russian Cup game. But e no end well as FC Baltika collect last-minute gbege wey break dem heart.

FC Baltika's Tenton Yenne dey celebrate em first Russian Cup goal

Even though Yenne knack one sweet equaliser early and show say him get ginger for Group 4, Round 1, the whole shine still dull last-last as dem lose 2-1 to Akron Togliatti on Tuesday night for Solidarnost Samara Arena, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Tenton Yenne Don Open Goal Account for FC Baltika

Game never even start well, na so home team Akron Togliatti score first for 7th minute—Benchimol use him leg convert one penalty like say e no hard.

Nigerian forward Tenton Yenne wen em dey ball for di Russian Cup match

But Yenne no gree, him reply back 7 minutes later with correct finish—e be like say the guy wan show say e mean business.

Him first goal for Baltika balance the score 1-1 and give hope to him team afta em enter for di middle of defenders just tap di ball enter net.

  Stephen Alfred Fire Big Goal Wey Carry Torpedo Go Next Round for Europe

The 25-year-old left winger, wey sabi run die and get muscle, dey shine for first half like new bulb.

But even with all the shakara, win no come.

As match enter extra time, na so Benchimol show again for 97th minute, knack another goal wey scatter Baltika plan.

The goal pain like heartbreak wey no get paracetamol.

Yenne Dey Ball, But Baltika Defence Fall Yakata

Even though na Yenne carry the spotlight, him Nigerian brother Chinonso Offor—wey score last match against Spartak Moscow—no even show face for this one.

  Stanley Charles Burst Net As FC Trinec Wipe Slovacko B 5-0 for Czech Liga 3

Tenton Yenne dey celebrate em first goal for Russian Cup

Baltika no fit find their rhythm at all. After Yenne equalise, the whole team still dey waka anyhow, and their defence no hold water as pressure come late.

Yenne try wella, but the wahala wey land dem na big one. Now dem go need hustle double to come back strong for next match.

Tenton Yenne just join Baltika from Ararat Armenia, where him do well no be small.

Between 2022 and 2025, the guy net 47 goals for 114 games—na proper baller for there.

Now e don play 3 games for Russia, and e dey eye that same hot form—or even better—wey e get for Armenia.

Wetin Come Dey Next for Yenne and FC Baltika?

Since e don start to dey score, everybody go dey watch to see how e go take settle down for Russian league.

  Zaidu Sanusi Shine Like Police Torchlight as Porto Use Gil Vicente Do Yeye for Backyard

Tenton Yenne score.em debut goal for FC Baltika for Russian Cup

Next match na league game against FC Orenburg on Sunday, August 3rd. Na another chance for Yenne to show say him no come play.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 30, 2025 8:05 am by Hitvibz Media