Super Eagles midfield engine Raphael Onyedika and small-but-dangerous striker Kaye Furo try their best run am for Club Brugge, but the thing still end 3–2 for Sint-Truidense side.
Na one of those matches wey go make you shout, “Abeg wetin dey happen for these people?”
Raphael Onyedika Burst Net Early
Na so Onyedika take ginger the match for 16th minute. Baba enter box like person wey know im house address, package one correct finish pass Sint-Truidense keeper Leo Kokubo, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Omo, the thing calm like Sunday morning tea.
Na im first league goal this season, and the guy dey gather momentum steady-steady as AFCON 2025 for Morocco dey near. You fit see say the engine room don dey warm up proper.
But as Brugge dey shine small, Sint-Truidense just vex, score two quick ones, and turn the whole match upside down. Football no get joy sometimes.
Furo Enter, Show Himself With First Ever Goal
Later, na Kaye Furo matter come loud. Coach bring am on for 64th minute, and the boy no even let grass grow under him leg.
Just six minutes enter pitch, boom — the 18-year-old smash im first senior goal for 70th minute. Scoreline balance 2–2, stadium scatter.
Movement on point. Pace dey. Composure dey. You go just dey look am like, “This pikin dey cook something.”
But wahala still hook Brugge. For 81st minute, Andrés Ferrari of Sint-Truidense score again.
Furo try rescue them late-late — the boy release missile — but na crossbar wey block am. If that ball enter ehn, everywhere for catch fire.
Youngstar Wey Get Two Countries Dey Drag Am
Furo no be small pikin for football house. Im papa na former Super Eagles defender Furo Iyenemi, so the DNA no lie.
The boy fit play for both Nigeria and Belgium, and he don already ball for Belgium U19.
This season na like breakthrough season for am — debut for Croky Cup, league, even Champions League qualifiers. Na so him name dey enter everybody mouth.
At the end, Onyedika early pepper and Furo landmark goal sweet, but Brugge still waka commot Daio Wasabi Stayen Stadium empty-handed.
Football no balance — but these Naija boys dey give correct bragging rights.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on December 7, 2025 12:20 pm by Hitvibz Media



Stay connected