Michael Ogungbaro Tear Net for FF Jaro But VPS Spoil Show For Dem Las Las

Michael Ogungbaro Tear Net for FF Jaro But VPS Spoil Show For Dem Las Las

Michael Ogungbaro nack one wicked long-range goal wey tear net on Friday give FF Jaro 2-1 lead, but VPS come spoil the party with one late equaliser wey make the match end 2-2 for Finland Veikkausliiga.

VPS boys shock after Michael Ogungbaro fire one wicked goal

Even though the Naija baller show him class, the match end 2-2 for Project Liv Arena TN, and fans just dey mix feelings, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Michael Ogungbaro Thunder Goal No Fit Carry Jaro Win

The 29-year-old Nigerian midfielder burst fire one correct banger for 68th minute wey carry Jaro take lead after gbege match.

  Philip Azango Dey Hot: Baba Score, Give Assist as Spartak Trnava Tear Hibernians Like Paper

The shot na outside box missile — na him second goal for the season, after the one wey he score June 28 for the 3-2 loss against KTP.

FF Jaro midfielder, Michael Ogungbaro dey show him skill for Veikkausliiga match.

Before Ogungbaro nack him own, na Tristan Dekker score first for the away team for 50th minute.

But Jaro no gree dull — Adam Vidjeskog come fire back sharp-sharp level the game and ginger the home fans.

Ogungbaro then land the killer blow — one heavy rocket wey make the score 2-1, and everybody reason say the 3 points don sure.

VPS Come Spoil Jaro Parry With Late Goal

But before Jaro fans fit even calm down, VPS come respond fast-fast. Just two minutes after Ogungbaro banger, Maissa Fall score for 70th minute make everything 2-2 again.

  Sunday Adetunji tear net as Ballkani survive Floriana wahala for Conference League

From there, both teams just dey try find winner but e no come. Dem share the points like say na puff-puff.

Michael Ogungbaro dey jolly as e score goal for FF Jaro against VPS

Ogungbaro don play 16 matches this season, start 12 out of them.

The guy dey steady deliver for Jaro and this goal na one of the big moment wey fans no go forget in a hurry.

Next match na against Oulu on August 2, and Jaro go wan turn these kind performance into full 3 points.

  Philip Otele Don Design FC Basel With Goals – Fire Two Against Grasshopper
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 26, 2025 2:26 pm by Hitvibz Media

Be the first to comment on "Michael Ogungbaro Tear Net for FF Jaro But VPS Spoil Show For Dem Las Las"

Leave a Reply