Umar Abubakar shine die Monday night as e knack goal wey carry him team, Famalicão, waka comot AVS Futebol SAD (AFS) 3–1 for home for Portuguese Liga.

Umar Abubakar, the new Erling Haaland celebrating his first goal

Dem don dey call am the new Erling Haaland, and Abubakar dey show say him get level, as e seal correct performance with third goal wey make Famalicão win sweet for Estádio Municipal 22 de Junho, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Umar Abubakar Dey Show as Famalicão Carry Win

For this round-21 Liga match, the 19-year-old Naija forward knack him first goal for the season after 11 games.

  Terem Moffi magic no reach as FC Porto chop last-minute dagger vs Famalicão

Even though chances scarce—he don only play 166 minutes for the season and usually dey come for small cameo—Abubakar finally get him first start, and him no waste am.

Umar Abubakar scores in Portuguese Liga match Famalicão vs AFS

Him play 74 minutes before Simon Elisor come replace am.

First half soft, but second half na where the wahala start, as goals begin land, with visitors first score.

Second-Half Fire Make Famalicão Chop Win

Just five minutes after second half start, Diego Duarte give AFS lead, but e no last as Justin de Haas equalize for Famalicão five minutes later.

  Terem Moffi magic no reach as FC Porto chop last-minute dagger vs Famalicão

Pedro Santos come dey ginger, him set up Antoine Joujou to put Famalicão ahead for 63rd minute.

Famalicão striker Umar Abubakar in action

Santos still dey hustle, come set Abubakar for simple tap-in just four minutes later to lock the win.

This win dey push Famalicão go sixth place with 32 points, as dem dey look forward to Sunday clash against Sporting CP.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 10, 2026 12:13 pm by Hitvibz Media