Na real gbas gbos wey shele for Estonia Cup on Friday night as four Naija ballers run mad show for Tamme Stadium. JK Tammeka no waste time at all, dem burst JK Tabasalu 6-0 for di Round of 64 one-leg knockout match.

JK Tammeka boys dey flex wella after dem tear Tabasalu 6-0

The Naija boys—Olawale Tanimowo, Ganiu Ogungbe, Ahmed Adebayo, and Ignatus Williams—all score for di match, make sure say Tammeka carry di waka with style, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Tammeka Start Fire Early, Tabasalu No Fit Breathe

From kickoff, Tammeka mean business. Na so England-born baller Olawale Tanimowo start the wahala sharp-sharp as e score just two minutes after game start. E no even give Tabasalu time to balance.

  Muhamed Tijani Show Say E No Come Joke, As Afolabi, Ghali Scatter Czech League

Naija stars dey jolly as JK Tammeka knack win for Estonia Cup

Just 13 minutes later, experienced defender Ganiu Ogungbe knack another one – 2-0.

Before Tabasalu fit recover, Ahmed Adebayo, wey be 23 years, add another goal make am 3-0. Dem never even reach 20 minutes, score don dey run.

Before first half end, Patrick Veelma join the groove, make am 4-0. Everywhere burst, home fans dey shout, away team dey confuse. The Naija boys no gree at all.

Williams Carry Second Half Put for Him Pocket

Second half start, and Tammeka still dey burn fuel. This time, na Ignatus Williams wey take stage.

Ignatus Williams nack two goals for Estonia Cup match

The Naija striker score two times—first one for 70th minute, another one for 80th. E wrap the match with him own brace – final score 6-0.

  Ahmed Adebayo and Ganiu Ogungbe Goal No Reach as Tammeka Fall Yakata Again

Five of the six goals na Naija boys knack am. Tabasalu no see road at all. Dem try but Tammeka too sharp, fast, and deadly.

This kind win sweet Tammeka belle, especially as dem just lose 2-1 to Flora for their last match.

Out of their last five games, na only two dem win—but this kind match show say dem dey hungry to bounce back proper.

Wetin Next for Tammeka and the Naija Ballers?

After this serious 6-0 demolition, Tammeka and their hot Naija talents go focus on the next match.

  Ahmed Adebayo Still Dey Hot, Drop Assist as JK Tammeka Fall for Home vs Flora

Dem go face Kalju on August 3. As dem dey on fire now, dem go wan continue the vibes for league and cup.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 26, 2025 2:21 pm by Hitvibz Media