Ahmed Adebayo no dey slow down at all as e still dey ginger for Estonia Premium Liiga.
This time, the Nigerian baller knack better assist for JK Tammeka—even though dem still chop 2-1 loss for house against Flora, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Adebayo Still Dey Shine for Estonia Side
Di 23-year-old Naija striker dey on fire lately, and for weekend match, e show say e leg still dey sweet.
Just two minutes after Flora knack dem second goal, na Ahmed Adebayo sharp eye pass give Giacomo Uggeri wey slot the ball for net make am 2-1.
That goal give small hope say comeback fit happen.
But as dem try push, Flora bone dem wella. Dem no gree allow another goal enter as dem hold body for second half collect full three points waka comot.
Na Markus Poom first open the scoring for 17th minute, then Andreas Vaher double the wahala just seven minutes later.
Tammeka no dull, dem answer quick with Adebayo wey arrange correct assist to cut the gap.
Even with all di pressure for second half, JK Tammeka no fit level the matter.
Ahmed Adebayo Form Still Dey Burn Like Fire
With this new assist, Adebayo don run collect six goal contributions for him last five matches—five goals and now one assist join.
Di guy dey ball anyhow and na one of the reasons wey dey still give fans hope say better days dey come, even if results never sweet all the time.
Adebayo play 61 minutes before coach comot am put Tanel Lang. Another Nigerian, Ezekiel Olawale Abiola, play full 90 minutes before Robin Mathias Müür replace am.
After 21 games, JK Tammeka dey 7th for table with 19 points. Dem still dey behind second-placed Flora with 28 points.
Dem next match na big one against Nõmme Kalju on August 2. Everybody go dey look Adebayo to carry fire again and help the team secure better result.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 21, 2025 6:56 pm by Hitvibz Media



Stay connected