As e be like dis eh! Polish football don enter another level of ginger with the arrival of one serious 21-year-old Nigerian forward: Samuel Akere.
He don join Widzew Łódź permanently, on a deal wey go reach June 2029, with option to extend am for one more season, Hitvibz reports.
Akere get big dreams to conquer, and im style of play, wey e say one Chelsea star dey inspire am, go surely bring fresh fire to the club for the coming 2025/26 season.
Samuel Akere Get Correct Plan After Em Join Widzew Łódź
Originaly from Botev Plovdiv for Bulgaria, where e hold ground for two seasons, Samuel Akere don gather plenty experience even though e still young.
He play 70 matches for the Bulgarian top league, give 8 goals and assists, just to show say e sabi attack.
When e dey Bulgaria, e even carry Bulgarian Cup for 2023/24 season, wey make dem play Europa League and Conference League qualifiers. E show face for six matches there and score one goal.
Before e move go Botev for 2022 when e just turn 18, Akere sabi polish im skills for Bulgarian second league, e play 23 matches and score three goals.
Im journey start from G12 FC for Nigeria, before e travel go Vista Gelendzhik for Russia for 2021, before e finally land for Bulgaria.
Samuel Akere na left-footed right winger mainly, but e sabi play anywhere. E fit play well for left wing, attacking midfield, or even as main striker.
Wetin make am stand out, as e yarn am himself, na im maddest dribbling, e no dey fear defenders, im speed too much, and im shot dey heavy.
He talk say Pedro Neto, wey dey play for Chelsea, na im role model, because e admire all the things Neto dey do wey Akere still dey try learn.
“When I bin read about Widzew Łódź, the atmosphere really sweet me,” Akere tell em new club website, as e emphasize say em don ready to commit to the club’s plans. “I be footballer wey get ambition. I wan win trophies and fight for European cups.”
Mindaugas Nikolicius, the Sports Director for Widzew Łódź, come kuku confirm the transfer, e say,
“I happy say we welcome one young player to Widzew, wey the club go help grow im football, and we hope say e go help us get success next season.”
Widzew Łódź Don Get New Attacking Style
Akere’s arrival na serious big boost for Widzew Łódź’s attacking power for those wey know am wella. E get special brain to analyse situations quick quick and make sharp decisions.
Im ability to do one-on-one, plus im talent to create space for field, make am constant threat to opposing defenders.
Im speed dey make am always attack the space behind rivals’ defense lines, and even though im main focus na attack, e still sabi defend well.
This complete skill set fit perfectly with Widzew Łódź’s plan to compete at the highest level and use a strong, attacking style.
Fans of Widzew Łódź go surely enjoy this my guy exciting performances as e go try fulfill im potential and help the club reach their goals.
Leave am! Akere go finish work for Poland.
You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on June 4, 2025 4:57 pm by Hitvibz Media




Be the first to comment on "Samuel Akere don run go join Polish Club Widzew Łódź, say em don ready to conquer like Chelsea star"