Kelechi Iheanacho don talk say him chest fall and emotion carry am go where he no know, after he score that late winning goal wey make Celtic win Motherwell 3-2 for inside Scottish Premiership match wey happen for Fir Park on Wednesday night.
The Nigerian striker start the match for bench, but na him come show pepper when everywhere red, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Kelechi Iheanacho show him senior man level for Celtic
He cool down, knack the penalty enter net for the dying minute to collect all three points for Celtic, as dem dey fire go carry the league title.
As the game don hot and everybody heart dey beat, Kelechi Iheanacho stand gidigba for the penalty spot.
He send the goalkeeper, Calum Ward, go buy bread for market as the ball enter net, wey make Celtic fans start to shout and jubilate like say tomorrow no dey.
This win don make Celtic draw closer to carry the Scottish Premiership cup again, and now dem get only one match left against Heart of Midlothian.
After the match finish, Iheanacho no fit hide the ginger wey dey him body because of the important goal wey he score.
“To tell the truth, I no even get words to talk, I no know how we take do am… but we don do am. As you see so, the fans still dey shout, we happy well-well, and we get one more game to play. We need to go back now go focus on that one,” na so he tell Sky Sports via BBC.
Iheanacho yarn about the pressure to score that penalty
The Super Eagles striker also open up about the tension wey he feel as he wan take that penalty, especially as the league title dey for line.
“I just try cool my heart, because the thing scary, but thank God say we win, so we dey happy.”
Iheanacho no really easy this season since he join Celtic as free agent, because wound-wound (injuries) bin disturb him rhythm for some parts of the season.
But even with all those wahala, the former Leicester City forward still dey show say he be key player for Martin O’Neill team.
The 28-year-old boy don get eight goals and one assist for the 22 matches wey he don play for all competitions this season.
This him last goal fit be the one wey go finally give Celtic the Scottish Premiership title.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on May 14, 2026 6:46 am by Hitvibz Media



Stay connected