Rangers striker, Cyriel Dessers, burst enter starting eleven on Tuesday night like thunder, as im help Rangers scatter Viktoria Plzeň 3-0 for UEFA Champions League third qualifying round.
Rangers boss, Russell Martin, no fit hide im joy as di Naija striker show full action for Ibrox, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Di 30-year-old Super Eagles baller wey don dey mostly for bench since di season start, use goal and assist take mark im return — show say e still be big piece for Rangers attack.
Rangers Coach Dey Praise Cyriel Dessers’ Full Package
As e dey talk for club website, coach Martin explain why Dessers never dey start matches before.
“We never too fit start Cyriel since, because im play one game against Middlesbrough, small injury catch am. So we just dey manage am back. But tonight, e burst well,” na wetin Martin yan.
But no be only im goal and assist sweet di coach. Martin also hail how Dessers sabi move without ball and how e dey help im teammates shine.
“We score correct goals tonight. Cyriel work mad — e carry defenders follow am so others fit run enter space. E hold ball well too,” e add.
Transfer Wahala Still Dey Hover Even After Plzeň Show
Even though Dessers show say e still get fire, talk still dey fly say e fit comot soon.
Tori dey fly say AEK Athens, Greek champions, dey eye am, and Rangers dey find around €5 million before dem go gree sell.
But the Super Eagles striker — wey be top scorer last season — dey focus on one thing: make sure say Rangers enter Champions League group stage.
As transfer window dey close small small, decision go soon land on top im head.
But till then, make we dey hope say this Plzeň match na the turning point for both Dessers and the club.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 6, 2025 7:10 am by Hitvibz Media



Stay connected