As NPFL 2025/26 season dey near, Nasarawa United don show say dem no dey play this time, after dem knack newly promoted Wikki Tourists 3-2 for one hot preseason gbas gbos showdown.
The Solid Miners show say dem ready for war as dem carry better football, strong mind, and correct tactics enter Group A for Gusau/Ahlan Cup Preseason Tournament, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Serious Wahala, Plenty Goals, Nasarawa United Don Dey Para
No be small friendly ball wey happen for Lafia City Stadium as Nasarawa jam Wikki Tourists wey just bounce back to NPFL.
Na Nasarawa score first after Joe Frank chop foul for box, and Utake Emmanuel sharply slot in the penalty.
Wikki come equalize sharp sharp, but before halftime reach, Joe Frank collect him revenge with correct finish wey put Nasarawa ahead again.
As second half start, Wikki still show say dem no come joke — Salisu Abdullahi fire dem back to 2-2.
But wahala never finish — Chidera Nduka burst net with long-range thunderbolt wey burst everybody brain, and na so Nasarawa seal the win.
This kind match na test run for Nasarawa—dem show say dem get game plan, bench depth, and strong mentality. Dem dey ready for NPFL proper.
Wikki No Fall Hand, But Nasarawa Get Iron Body
Even though dem lose, Wikki Tourists show say dem no be learners. Dem come back twice for the match—e show say dem hustle no be today, and dem fit handle any team for league.
This game na better test for dem level, and as NPFL go soon start, dem go need build on this fire.
As e be now, Nasarawa don get six points from two games (dem first game na 5-0 wey dem use wash SI14), and dem dey on cruise control to qualify for quarterfinals.
Players like Joe Frank, Utake Emmanuel (wey collect Man of the Match), and Chidera Nduka don dey shine, and coach Stephen Moga go dey smile say him boys dey ginger to carry this form enter league proper.
Wetin Remain?
Nasarawa go play their last group match against Benedict Akwuegbu FC — dem wan finish group with clean slate and balance fitness before NPFL kickoff.
As for Wikki, this tournament still dey give dem chance to blend the squad well, get match sharpness, and boost morale.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 6, 2025 10:40 am by Hitvibz Media




Stay connected