Philip Otele no dey joke this season at all. E either dey tear net or dey serve correct assists. This time, na the second one e do, as e ginger FC Basel take scatter Young Boys for Swiss Super League match.

Philip Otele don assist in FC Basel’s win over Young Boys

Last week, the Naija baller knack two goals as dem beat Grasshopper 2-1. Now again, Otele don show say e no be fluke, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Philip Otele Light Up Basel Frontline As Dem Rubbish Young Boys

For Round 4 of the Swiss League, Basel no even show pity as dem wipe Young Boys 4-1 for St. Jakob-Park on Wednesday night. And na our Naija guy, Otele, wey dey control midfield like say na him get am.

  Philip Otele and Francis Ezeh burst ground with goals and assists as Basel and Keçiörengücü collect sweet wins

FC Basel players for Swiss Super League clash with Young Boys

E give dem winning assist again—carry im season tally go 2 goals, 1 assist. Omo, the guy dey burst brain.

Basel Para for Dia Visitors – Dem No Gree At All

Basel just dey shine for their turf. Dem scatter everywhere, and Xherdan Shaqiri na the main man wey cause wahala.

Young Boys first shock everybody as Darian Males score for 17th minute after one sweet pass from Edimilson Fernandes.

But Basel say dem no come play. Shaqiri reply dem for 39th minute—sharp goal after Dominik Schmid set am up nicely.

Philip Otele dey celebrate em goal for FC Basel vs Young Boys

Wahala come burst for second half as Fernandes collect red card—Young Boys come remain with 10 men.

Basel no waste time. Shaqiri tear penalty net for 60th minute—2-1.

  Philip Otele dey hot for AFCON 2025 race as Uchenna Ogundu, Monday Etim tear net for Cup matches

From there, e be like say dem open floodgate. Kevin Carlos add another one for 75th minute after Otele dish out better assist.

Then for dying minutes, Metinho seal am with one composed finish—4-1 finish!

Wetin Dey Next for Otele and Em Teammates?

Basel go travel go face Lugano on Sunday, full of ginger.

Otele go wan continue this him hot form as e dey try pass last season record—9 goals, 4 assists in just 21 games.

  Fred Onyedinma Help Wycombe Enjoy Big Win as Philip Otele Shine for Em Bundesliga Debut

With the way e dey play, Otele fit be that secret weapon Basel need to carry this league again and hold pressure for neck of their rivals.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 6, 2025 11:23 pm by Hitvibz Media