Real Zaragoza don complete the signing of William Agada, as the Nigerian forward don land Spain on free transfer to boost the club attack till end of the season.

William Agada unveiled as new Real Zaragoza forward

The 25-year-old don come after him contract finish for America, and e don sign deal wey go keep am for Zaragoza till June 2026, na weytin hitvibz dey yan be dat.

William Agada bring speed and flexibility enter Zaragoza attack

Agada na player wey get speed, strength, and better experience from different leagues, and Real Zaragoza no waste time to lock am down before other clubs fit enter the race.

William Agada, wey dem born for Bauchi, Nigeria, na fast attacker wey sabi play for center or from wing. E fit stretch defense and give coach more options for front.

William Agada joining Real Zaragoza on a free transfer

The signing match wetin Real Zaragoza dey find — player wey fit run, press, and score. Plus, na correct business move as dem sign am free-free while e still dey sharp age.

  Real Zaragoza Done Sign Peter Ademo For 4 Year Deal: From European Nights to Rescue Mission for Spain

Agada journey from Israel, MLS, come land Spain

Before now, William Agada spend most of him career for Israel and Major League Soccer (MLS).

Na for Hapoel Jerusalem e first really blow, as e score pass 30 goals for 100 matches.

William Agada in action before move to Real Zaragoza

For 2020–21 season, e play for Hapoel Haifa, score six goals and add four assists for 26 games.

By 2022, Agada move go America join Sporting Kansas City, where e make serious impact for MLS with 24 goals and six assists for 77 matches.

  Alhassan Yusuf Show Cincinnati Pepper as New England Revolution Wire Dem Weytin No Good for MLS

That performance carry am go Real Salt Lake, where e play for 2025 season. Even though e score three goals and get two assists for 26 games, him work rate and experience still show well.

Now, after him contract don finish, William Agada don start fresh chapter with Real Zaragoza, ready to prove himself for Spanish football.

The club welcome am officially, wish am luck, and tell am make e go hard for this new chapter.

Agada too drop emotional goodbye message for Instagram, thank him former club, teammates, staff, and fans.

  Victor Olatunji Finally Burst Net for MLS, But RSL Playoff Dream Don Dey Enter Offside

E talk say the love and support carry am through tough times, and say the chapter go always mean something special to am.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 27, 2026 6:56 pm by Hitvibz Media