Ademola Lookman don tanda gbege for him career after e move from Atalanta go Atletico Madrid.

Ademola Lookman unveiled by Atletico Madrid

The Naija striker don land Spain with solid creds, but to play for Diego Simeone side go mean gbege wey go test him level, mindset, and how steady him fit perform for top top football, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Ademola Lookman dey ready for Simeone wahala for Atletico Madrid

Ademola Lookman don sign contract wey go last reach June 2030, the deal dey worth like €35 million, plus add-ons wey fit make am near €40 million.

Dem show am proper for Riyadh Air Metropolitan auditorium, na so him La Liga journey start.

Now, Lookman dey under Simeone hand, one coach wey no dey joke for discipline.

Simeone team sabi how to dey focused, dey sharp, and dem dey expect tactical brain from all players, especially dem wey dey wide.

Ademola Lookman ahead of Atletico Madrid debut

For Lookman, this move na respect for how him don dey shine before, but e still mean serious wahala to adapt for top level, to gain trust and get regular minutes.

  Super Eagles stars Paul Onuachu, Chibuike Nwaiwu, and Nwakaeme ginger Trabzonspor make dem beat Galatasaray

Lookman dey face Simeone test after him kill am for Atalanta

Lookman land Spain after e burst Atalanta with 55 goals and 27 assists.

Him big moment na 2024, wen e score hat-trick against Bayer Leverkusen for Europa League final, na him carry Atalanta first European trophy come.

Ademola Lookman joins Atletico Madrid from Atalanta

After dem show am to public, Lookman yan:

E sweet to dey here; this club na correct one. Na blessing to dey here; I dey happy say I don land.”

Him also yan about how e go take adapt to new environment and wahala wey dey come:

  Genk Oga Don Blow Horn for Tolu Arokodare: "First Super Eagles Call-Up Na Just The Start, More Goals Go Land"

“I don play for three top leagues before. Now I dey enter another big league, big country. New language dey, new challenge dey, but I dey gbadun am, I dey ready for am.”

Na him talk say him talk with Simeone help am decide move, cos e know say this go sharpen him game.

Lookman clear sey him mindset dey correct as e join squad wey discipline and dey always dey sharp:

I like to learn, I like to improve; na wetin I dey look forward to. I wan join the guys, correct footballers, and also help as much as I fit,” the tricky winger yan.

Him yan sey e dey hungry to improve every day:

“I wan dey my best every day. I wan improve, because I know say I fit improve. New challenge dey, e dey excite me.”

Ademola Lookman display his new jersey and number at Atletico Madrid

The 2025 AFCON Best Playmaker believe say him speed, work rate and how e dey knack key moments go match Simeone style for Atletico Madrid.

  3 Naija Boys Shine for Europe: Akor Adams Score, Gift Orban Give Assist, Salim Lawal End Em Goal Drought

The former Premier League star fit make him first appearance Thursday night when Atletico face Real Betis for Copa del Rey, so fans fit see quick how e go gel with him new team.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 4, 2026 8:03 am by Hitvibz Media