Super Eagles boy Gift Orban no dull at all for Sunday afternoon show. The guy dey ginger like say dem put battery for him leg — one sweet assist, nearly score sef, but Verona still manage lose 2-1 for house to Inter Milan. Serie A wahala no dey finish o.

Gift Orban celebrates his assist for Hellas Verona

The 23-year-old don play nine league games this season, and this one na another banger performance, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Gift Orban Cook the Equaliser, But Village People Still Do Meeting Late

From kickoff, Orban dey everywhere like okada man wey no get brake. Every Verona attack get him name inside.

Baba Orban hustle pay just before halftime — he serve Giovane correct pass wey the guy hammer inside net. Na him first assist this season, and the crowd burst like say dem just win league.

Gift Orban in action during Hellas Verona vs Inter Milan

No even two minutes later, Orban nearly turn goal machine. He fire one missile wey shake post, Sommer for Inter just dey watch like Netflix. If that ball enter, na highlight reel goal be that.

  3 Naija Boys Shine for Europe: Akor Adams Score, Gift Orban Give Assist, Salim Lawal End Em Goal Drought

The boy play 73 minutes before coach comot am for Cheikh Niasse, but everybody know say the Naija boy show face well. Now he don get two goals plus one assist for Serie A — small small, the former “next big thing” vibe dey come back.

Inter Milan Use Last-Last Juju Steal the 3 Points

Orban and Verona try, but Inter na big boys wey sabi the street. Çalhanoğlu open scoring early with one fine volley — that kind shot wey make defenders begin do prayer.

  Gift Orban Tear Net, Create Another One but Verona Still Fall Hand vs Bologna for Serie A

Then when everybody don dey expect draw, Barella cross one ball for extra time, e jam Martin Frese and enter net like joke. Imagine the heartbreak.

Gift Orban Hits the Post, Bags Assist but Hellas Verona Fall Short Against Inter Milan

Verona fans just quiet — na so winless run don reach ten games now. Relegation zone still dey look them eye to eye.

Inter meanwhile don waka close to Napoli for top of table. Dem no dey play.

But for Orban? Baba fit raise head. E show hunger, show skills, and show say even if Verona dey sleep, Naija no dey dull. The boy dey ball — e just need better support.

  Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on November 2, 2025 10:13 pm by Hitvibz Media