My people, Super Eagles striker Anthony Ujah don finally hang him boot. Age 34, after two decades wey he don dey ball steady.
The guy say “time up,” and omo, emotions full everywhere. Na Sevilla forward, Akor Adams, even drop heartfelt tribute wey touch many, na weytin hitvibz yan be dat
Akor Adams on Ujah: Baba Wey Set Example
Akor Adams no even hide am. He call Ujah “real inspiration,” both for ball and for life.
The guy yarn say when he land for Lillestrøm SK, na there he see the kain love wey Ujah don build for that community. “Guy, dem people dey worship Ujah! Na so him weekend performances dey sweet their belle. And off pitch, the guy dey pure heart. Me sef come dey wish make I fit even do half of wetin him mean to dem.”
Akor talk say even before he meet Ujah, na the guy already ginger am to dream big. “Big bro, na legend you be. You don leave mark for plenty boys wey never even meet you. May God carry you go next level,” he drop am for social media.
If Akor dey praise you like this, no be beans. Ujah fit no wear Super Eagles jersey reach 50 caps, but bros get respect pass some wey don play Nations Cup tire.
From Warri Wolves to Bundesliga Big Boy
Make we rewind small. Ujah na Ugbokolo pikin, but na Warri Wolves him take first show face as pro.
From there, na Lillestrøm SK for Norway open the Europe door. Sharp sharp, Mainz come carry am 2011.
Germany na where him ball blow. Cologne, Werder Bremen, Mainz, Union Berlin – everywhere the guy show say he sabi.
Stats no lie: 136 Bundesliga games, 30 goals.
Bros dey 3rd for Nigeria all-time Bundesliga scoring chart – only Jonathan Akpoborie (61) and Victor Agali (32) dey front am.
Add join am: 37 goals for 2. Bundesliga, 7 for DFB-Pokal. No be anyhow striker. Ujah dey press like say na NEPA bill he dey chase, movement sharp, hold-up play na premium.
For Naija, the guy wear Super Eagles shirt 7 times. 2013 Confederations Cup, he even play for that 6–1 demolition of Tahiti. Last cap na 2015 vs Niger.
Street banter: no be every striker go score for Super Eagles, but Ujah go forever dey ball gist because of wetin he do for Europe.
The Final Whistle: Injury Stop Am
Na one wicked patellar tendon injury for Botev Plovdiv (Bulgaria) spoil show. E happen for Europa League qualifier vs Panathinaikos. Omo, career end just like that.
But legacy? E no dey injured. Ujah don cement him name. Warri Wolves boy wey jam Bundesliga and scatter nets. Bros show say Naija strikers no dey carry last.
Ujah no just retire, na respect wey he carry waka comot. Legend no dey fade.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 29, 2025 2:11 pm by Hitvibz Media



Stay connected