Super Eagles of Naija don bow out for AFCON 2025 with serious heartbreak after dem lose to Morocco for penalty shootout for Wednesday semi-final wey happen for Rabat.

Super Eagles coach Eric Chelle reacts after Morocco loss

After full 90 minutes plus extra time end for zero-zero, na Morocco carry the day for penalties, beat Naija 4-2, con book their ticket go final, na weytin hitvibz yan be dat

Super Eagles no make am as Morocco edge dem for penalties

For the match, na Morocco get better chances pass, while Super Eagles only manage two shots the whole game.

Morocco keeper, Yassine Bounou, na im really decide the matter as e save two penalties for Atlas Lions side. For Naija side, Stanley Nwabali manage save one, but e no still enough.

Super Eagles in action against Morocco at AFCON semi-final

Even though the Eagles perform well throughout the tournament, small-small margins still cost dem for Rabat, as Morocco show better control when e really matter.

  “Him voice”: Alex Iwobi don talk wetin em go miss pass for Troost-Ekong — plus two other things

Chelle talk wetin spoil Super Eagles game

After the match, Super Eagles coach, Eric Chelle, talk say dem fall hand for some important areas.

We miss plenty things – intensity, tactics, movement. Morocco deserve the win, but our mindset good; we fight for every ball. The match no easy at all, but the players try respond well,” Chelle talk.

“E pain because we lose again for penalties. E sad because we work well for training, but na football be this, we gats accept am.”

Chelle also talk say tactical issues, especially their pressing game, really affect the team.

  Tolu Arokodare don tear net 16 times for Genk – Super Eagles coach go dey see am for dream every night

Super Eagles goalkeeper Nwabali during penalty shootout

We play 4-4-2 diamond, and if you use that formation, you must press high. If you no do am, you go suffer.

“For the first 15 minutes, our pressing dey okay, but after that, we dey miss one metre, two metres, and e make things hard for us. The high pressure no work again, and technically e no still be the same,” he add.

Now, Naija go shift focus to finish the tournament well as dem prepare for third-place match against Egypt next.

  Ademola Lookman score for em first Madrid Derby, as Chidozie Awaziem assist no save Nantes from heartbreak
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 15, 2026 7:50 am by Hitvibz Media