Omo, this our Naija babe, Joy Omewa, na real baller. Since last season for Fortuna Hjorring, she don dey carry fire for leg.

Joy Omewa dey celebrate scoring for Fortuna Hjorring against Hibernian

On Wednesday again, she show say e no be fluke as dem jam Hibernian for UEFA Women Champions League one-leg qualifier, na weytin hitvibz yan be dat

Na she fire goal wey ginger the Danish babes, make dem knack 2-1 for their Scottish visitors.

Joy Omewa Equaliser Na The Ginger Wey Turn Everything

See cruise—22 years only o! The girl na striker wey dey behave like seasoned Super Eagles no.9. Na her equaliser for 70th minute change the whole storyline. From 1-0 down, dem waka turn the match upside down.

And no be by mistake—babe don dey hot! She score two goals last weekend for Denmark league when dem hammer Aarhus 4-0. Now na three goals in three straight games. Abeg, if this one no be “form,” na wetin?

  Victor Osimhen don scatter Champions League again with 2 goals against Bodø/Glimt

Fortuna Hjorring players dey celebrate late Champions League winner

Super Falcons coach suppose dey reason her like how Arsenal fans bin dey reason new striker. Girl dey deliver when e matter pass.

The match sef na wahala—Hibs think say dem go carry draw reach extra time, but last-gasp goal for 90+ by Nikoline Lilly Nielsen scatter everywhere. Fans begin celebrate like person wey chop jollof after one week hunger.

Hibs Dey Waste, Fortuna Dey Cash Out

Match start like film. Just four minutes, Kathleen McGovern get penalty—omo, she drag am wide like Chelsea striker last season wey no dey sabi net. Fans shout, “Ah-ah, wetin be this now?”

  Vincent Kompany do wetin others no fit do as e break 25-year Real Madrid curse for Bernabeu

As if say e no do, three minutes later our own Joy Omewa get her own pen. Na im she too miss! Na penalty miss vs penalty miss—like say dem wan do comedy skit.

Joy Omewa dey react after winning Hibernian 2-1

Second half, Hibs no waste time. 47th minute, Rachael Boyle knack goal sharp-sharp. E be like dem don dey control everything.

But football no be mathematics. Omewa talk say, “Make I clear my name.” 70th minute, she slot am clean. 1-1. Everybody don dey calculate extra time like mathematics teacher.

Then boom! 90th minute wahala. Nielsen appear like Messi for last minute. 2-1. Home fans scatter like dem win World Cup. Hibs just dey look like Arsenal fans after bottling league.

  Arsenal break Portugal jinx as Kai Havertz late clutch goal finish Sporting CP for Champions League

At the end, na Fortuna carry di win, Hibs.come dey regret.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 29, 2025 6:29 pm by Hitvibz Media