Thursday night na confirm flex for Naija ballers as Wilfred Ndidi, Tolu Arokodare, and Bamidele Yusuf carry fire go Europe! The three Super Eagles boys show dem true color for UEFA Europa League and UEFA Conference League as dem drop goal and assist give dem clubs.

Tolu Arokodare celebrates his goal against Atalanta for Ajax

From Istanbul to Amsterdam, reach Budapest, these Naija boys prove say no cap, dem go always deliver anywhere dem place dem, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Ndidi Open Account as Beşiktaş and Crystal Palace Draw 2-2

Super Eagles captain Wilfred Ndidi don finally burst net give Beşiktaş! The 29-year-old midfielder score him first goal of the season inside dem tight 2-2 draw against Crystal Palace for Tupras Stadium.

Ndidi score for first-half extra time after Salih Özcan setup the ball give am. After the goal enter, Ndidi do one funny celebration where he use him own hand tap him shoulder. When dem ask am after match, he talk say:

Wilfred Ndidi goal against Crystal Palace in the Europa League — Naija ballers

“I dey tap myself for back, dey tell myself say ‘bravo boss, you try!”

Palace later come back strong for second half with goals from Yeremy Pino and Jean-Philippe Mateta.

But Beşiktaş boy Junior Olaitan score one heavy long-range shot for 73 minutes to equalize, before Ümit Akdağ collect red card.

  Tochukwu Nnadi don land for Marseille after AFCON shine, Jimoh-Aloba return to West Brom

The draw stop Beşiktaş 4-game home winning run for Europe, but dem still never lose any match for continent this season.

Arokodare Enter from Bench, Score Goal and Give Assist as Ajax Beat Atalanta

Inside UEFA Conference League, 25-year-old striker Tolu Arokodare enter as super-sub come show Atalanta pepper, as Ajax win 2-0 for Johan Cruyff Arena.

He enter match for 66 minutes to change Marcos Leonardo, and inside 21 minutes, Arokodare don scatter defense!

  Bamidele Yusuf Give Goal and Assist as Ferencváros Win UEFA Europa League Qualifier

Tolu Arokodare goal and assist against Atalanta in the UEFA Conference League

He run follow him own flick ball before he gently pass am enter net past Marco Carnesecchi. As if that one no reach, for dying minute, he assist Abdellah Ouazane to score the second goal from tight angle.

This win help Ajax break one bad record where dem never beat Italian club for home for 14 matches, and e give dem dem first 3 points for Conference League this season. Now, Arokodare don get 8 goals and 3 assists inside 13 matches this season!

Yusuf Join Other Naija Ballers Burst Net Again as Ferencvaros Pack Torreense 4-1

For Hungary side, Bamidele Yusuf open tap for Ferencvaros as dem flog Portuguese side Torreense 4-1 inside dem Europa League Round 3 match for Groupama Arena.

The 25-year-old forward fire the first goal for 20 minutes to end him 4-game goal drought. Even though Torreense equalize through Manu Pozo, Ferencvaros come back second half come load dem with more goals through Mariano Gómez, one own goal from Mohamed Ali Diadié, and Krisztián Lisztes late strike.

  AFCON sidon-look Rafiu Durosinmi shine again, close 2025 with killa goal for Czech League

Bamidele Yusuf celebrates his goal in Ferencvaros' 4-1 win over Torreense

Yusuf later comot for 75 minutes give Lenny Joseph, but him job don finish. The boy don now get 6 goals and 3 assists for 20 matches this season, and him goal help Ferencvaros win dem 3rd match straight for Europe to stay 2nd position for table!

Last Updated on October 23, 2026 6:56 am by Hitvibz Media