Ademola Lookman burst enter Spain like say na him own house as Atlético Madrid scatter Real Betis 5–0 for Copa del Rey quarter-final.

Ademola Lookman scores for Atletico Madrid vs Real Betis

The Naija forward no waste time at all. For him first match, he score one goal and still give assist, and e make coach Diego Simeone shower am big praise after match end, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Ademola Lookman show levels sharp-sharp for Atletico Madrid

Atlético Madrid sign Lookman from Atalanta for winter transfer window, and people get big expectations for am. But the Super Eagles man no keep anybody waiting — e carry matter for head straight.

For Estadio de La Cartuja, Lookman play major role as Atlético dominate the game from start to finish.

Atlético take lead early as David Hancko score for 12th minute, before Giuliano Simeone add second with calm finish.

  Victor Osimhen Don Score Again Before AFCON, Galatasaray Use Antalyaspor Do Saturday Rice

Na so Lookman take announce himself well-well. E run counter attack clean, score Atlético third goal — wey be the 100th goal for him professional career — and turn the night to something special for him debut.

E no stop there. Early second half, Lookman show say e get brain join leg as e tear Betis defence apart give Antoine Griezmann fine pass to score fourth goal. That one confirm say him na complete attacker.

Ademola Lookman in action for Atletico Madrid vs Real Betis (1)

The Nigerian international even set record, as na first Atlético Madrid player since 2013/14 season wey start debut against La Liga team and still score goal plus assist for one match.

Coach later remove am for 79th minute, before Thiago Almada come add final goal complete the 5–0 beating.

  Tolu Arokodare Story: From Belgian Golden Boot to Relegation for Premier League

Diego Simeone talk Lookman special qualities

After the match, Simeone full everywhere with praise for the Super Eagles star and talk say Lookman go dey very important for the team going forward.

Him qualities dey talk for themselves. E be different player from all the ones we get. E sabi one-on-one very well and still dey play combination football. That one give us chance to change positions.

We never know yet. E get very good impact for the team, e feel comfortable, hopefully we fit help am become even better footballer and e go help us grow as a team,” Simeone talk, as Football Espana report am.

This talk show why Atlético Madrid rush secure Lookman long-term deal, wey people talk say fit reach €40 million.

Ademola Lookman assists goal in Atletico Madrid debut match

With him direct attacking style, movement, and creativity, Lookman don give Simeone fresh options as Atlético dey push for Copa del Rey glory.

  Ex-Super Eagles Baller Yan Say Rivers United “Park Bus” Against El-Kanemi Warriors

With this kind start, Ademola Lookman don already cement himself as key man for Atlético Madrid attack — and one player wey fans go dey watch closely as the season dey go on.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 6, 2026 5:28 am by Hitvibz Media