Super Eagles baller Alex Iwobi don start im third season for Fulham with ginger, as the guy drop correct assist wey help dem hold Manchester United 1-1 for Premier League clash on Sunday.
The 29-year-old midfield machine, wey last season carry em team matter for head with 15 goal contributions (9 goals + 6 assists), don dey scatter ground early again, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Fulham Hold United as Alex Iwobi Shine
Iwobi na the chief conductor wey supply the cross wey ginger em team comeback, as dem knack equaliser make Red Devils no carry full 3 points waka comot Craven Cottage.
No be only am sef, Calvin Bassey wey be im Naija padi hold defence like say na agbada. The guy no gree give United frontliners joy.
Fulham sef don dey stubborn — na two back-to-back draws dem don secure after that Brighton 1-1.
First half na gbege, United nearly steal am. VAR show say Bassey pull Mason Mount for box, ref blow pen.
But Bruno Fernandes do oversabi, knack the ball like person wey dey play over-the-bar challenge. Home fans just dey hail am, “Thanks captain!”
Na second half e burst. United first score as Mbeumo corner waka go touch Muniz head small, sneak pass Leno. Own goal, wahala! Home team fans don dey shake.
But omo, Iwobi no gree. Fifteen minutes later, Emile Smith Rowe enter as sub, touch ball first time, and gbam! goal.
Na Iwobi cross from left — the kain delivery wey even DHL go respect — wey set am up. Smith Rowe no waste am.
Na that kain assist wey you dey clap for even if you dey support United.
Man United Try, But Iwobi and Em Team Just Dey Vex
Last minutes hot die. Jedi sef save Fulham as he block Mbeumo one-on-one wey fit don spoil their night.
Full-time whistle blow, 1-1. Both Fulham and United still dey find first win like lost pikin.
But make we talk true — na Iwobi wey carry spotlight. The guy don show say e fit ginger Fulham season again.
If he continue like this, omo, defenders go dey fear am like village masquerade for night.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 24, 2025 7:37 pm by Hitvibz Media




Stay connected