My people, see as Esther Okoronkwo dey hot like new generator wey just see fuel! Fresh from WAFCON 2024 where she and Super Falcons carry cup go house, the babe no even rest.
Just land from national duty, she don begin dey knack correct performance for her club, AFC Toronto, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Na so e happen for Saturday for Stade Boreale. Title race dey tight, Montreal Roses dey reason say dem go show dem power.
Esther Okoronkwo: From Carring Cup for Naija to Scattering Defence for Toronto
But na lie! 24th minute, Nikayla Small collect better through ball from Sarah Stratigakis, slot am inside net. 1–0. Toronto fans begin dance like say dem win league already.
Before Montreal fit breathe, 37th minute, Okoronkwo show say WAFCON no be by luck. Babe tear defence with sweet pass give Kaylee Hunter.
Hunter no dey joke — she fire one missile from outside box wey enter like Osimhen header.
Na her ninth goal this season be that. Esther don rack up her 4th assist for 11 NSL matches, plus she get 4 goals too. Na so you know say she dey cook!
Montreal still manage pull one back for first-half injury time through Stephanie Hill. But Toronto no gree, dem lock defence like Mourinho park bus.
How Esther Take Burst Montreal Bubble
Final whistle blow, 2–1, Toronto extend lead for top of table go six points.
Remember say for WAFCON, Esther drop six assists plus two goals, even score that high-pressure penalty for final wey make Naija women carry trophy.
Now for NSL, babe still dey cause wahala. 8 direct goal contributions in just 11 matches? Abeg, who go stop am?
October 18, Toronto go jam Montreal again for regular season finale.
If Okoronkwo still dey blaze like this, AFC Toronto fit carry their first-ever Northern Super League title.
Montreal better dey pray say she go get cold that day — but we sabi say this Esther no dey chill.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 10, 2025 12:33 pm by Hitvibz Media



Stay connected