My people, this ValueJet Preseason don start with correct gbege! E be like say dem mix preseason with pepper soup because the wahala sweet.
Ikorodu City shock everybody, Remo Stars chop scare but still win, and Rivers United plus Abia Warriors just dey do pass-the-parcel for 90 minutes, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Ikorodu City Clip Shooting Stars – No be film trick!
Na so the Lagos Oga Boys start their preseason wey tear ground.
Dem no even fear Shooting Stars—na big NPFL name o! Six minutes never reach, Joseph Arumala just waka enter with one goal wey resemble thief wey carry plantain comot for market.
After that, dem just lock door, throw key, frustrate Oluyole Warriors like say na landlord wey no gree collect rent.
Shooting Stars try break dem down? Lai lai. Ikorodu boys park bus, park Okada, even park trailer.
Dem don show say this preseason no go get small pikin team. Next match, dem go jam Kwara United, then Remo, then Abia Warriors before dem meet Rivers United. Wahala dey cook.
Remo Stars Weather Kwara Storm – Title holders no gree fall hand
For Ikenne training pitch, Remo show say dem still get champion DNA. Jerome score for 30th minute.
Before Kwara fit say “chai”, Victor Mbaoma add another for 37th minute—two-zero, everybody think say na walkover.
But Kwara no be mumu. Babatunde Bright fire one bullet for 39th minute, tension start. Second half come turn to Issah Gata vs Remo goalkeeper.
Two times, Gata nearly spoil show, but Remo keeper stand like wall for Old Trafford. Final whistle, Remo 2–1 Kwara. E no easy.
Rivers United & Abia Warriors – Na handshake match
Meanwhile for another venue, Rivers United and Abia Warriors play the kind football wey make beer parlour man sleep.
Goalless draw. Small chances dey, but both teams dey behave like striker wey no wan score because e owe defender money.
Next Match Preview
Where is your team standing after Matchday 1? #ValuejetCup25 pic.twitter.com/qxs4YMUDtc
— ValueJet Cup (@ValueJetCup) August 9, 2025
Monday 2:00pm—Kwara United go meet Ikorodu City. Remember say Ikorodu just knack Shooting Stars. Kwara no go wan shame twice. Me I go buy my suya early.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 10, 2025 9:27 am by Hitvibz Media



Stay connected