My people, di 2025 CAF five-year ranking don land — and omo, e sweet for belle! Rivers United don wear crown as Naija No.1 club, dem siddon wella for 24th for Africa.
Meanwhile, Enyimba dey chill for 35th spot, but NPFL champ wey just win league, Remo Stars, dem no even smell di list. Na so? Na so!
Rivers United Dey Run Things for CAF Rankings 2025
Omo, dis one na real twist wey go make next CAF Champions League hot pass harmattan sun, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Pride of Rivers don really show say dem no dey here play. No be say dem just be top dog for Naija, dem still be second oga for West Africa.
With 14 points for last five seasons, dem consistency don hold other Naija clubs for back seat.
Enyimba sef, wey still manage enter with 7 points, no go even dey play CAF ball dis season after dem knack sixth for NPFL.
So e be like say na Rivers United go carry Naija matter for head when CAF Champions League prelim round go start.
Remo Stars — Win League, No See Name
Chai, di real shocker na say Ikenne Boys miss road.
Sky Blue Stars wey carry NPFL last season and still try small for Africa, no even fit near top 70.
Na there you go know say CAF five-year point system no dey do “one season blow” — na who don dey hustle long time dem dey rate.
For Rivers United, dis ranking na ginger and bragging right join. As CAF Champions League preliminary draw go happen tomorrow, Saturday, August 9, 10am GMT, e fit decide whether dem go face small pikin or meet lion from round one.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 8, 2025 3:00 pm by Hitvibz Media



Stay connected