Na when wahala choke, na that time Super Falcons dey shine pass. Na wetin captain Rasheedat Ajibade talk after Nigeria knack South Africa 2-1 for semi-final of the 2024 Women Africa Cup of Nations (WAFCON).

Rasheedat Ajibade dey jubilate as Super Falcons knack goal for Banyana Banyana

As dem don lock ticket enter final, Ajibade come yarn say na serious pressure dey make Falcons show dem real colour, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Rasheedat Ajibade yarn: “Na when kasala burst, na em we dey turn beast”

The semi-final wey shele for Larbi Zaouli Stadium for Casablanca na real gbas gbos, as Super Falcons manage win South Africa (Banyana Banyana) inside hot match wey happen on Tuesday.

Ajibade first open scoring with correct penalty before halftime—na her first goal for this WAFCON edition be that.

Rasheedat Ajibade carry Woman of di Match for WAFCON 2024

But South Africa no gree. Around 60th minute, Linda Motlhalo use penalty balance the game after Osinachi Ohale jam Hildah Magaia for box.

  Egypt knack Nigeria 2–1 for Cairo Friendly Before AFCON Palava Start

Just as e be like say the game go drag enter extra time, right-back Michelle Alozie shock everybody with one thunderbolt from far—wey give Nigeria the winning goal sharp sharp.

As Ajibade dey reflect on the tough match, she talk say:

We sabi say e no go easy because this tournament no get soft game. South Africa na better team, we don jam dem before for Olympic qualifiers and past WAFCONs.”

She talk say dem ready both mentally and body-wise. But she still let cat out of bag:

“Na when wahala hook, na that time you go see real Super Falcons. The match hard well, but we no give up—we collect the W.”

  2023 Elections: There will be five major changes to occur - Yinka Yusuf Prophesies

Ajibade Don Win Woman of the Match Again, Falcons No Dey Joke

Rasheedat Ajibade—25 years old—don carry Woman of the Match title for the third time for this tournament.

Na serious gbege as Super Falcons jam Banyana Banyana for WAFCON semi-final

She dey show why she be one of Africa top players. The Atletico Madrid forward don drop one goal and two assists already for WAFCON 2024, and she dey lead like true captain.

Her ginger help Falcons push past South Africa and now dem go face Morocco for final.

Final Showdown na dis Saturday
Super Falcons—wey don carry African title 9 times—go knack heads with host country Morocco for Olympic Stadium, Rabat, this Saturday.

  South African Rap Star Riky Rick Dead Aged 34

Morocco reach final after dem beat Ghana Black Queens 4-2 for penalties after 1-1 full time.

Mission X dey load.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 23, 2025 9:05 am by Hitvibz Media