Super Falcons striker Uchenna Kanu dey hot like fire right now! For the second time this season, she show dem pepper as she score beta hat-trick take help Cruz Azul Women waya Toluca Women 4-0 for dia own backyard for Mexico Liga MX Femenil.
Kanu first wire two goals for first half, before she come use one late goal wrap up the hat-trick. The match wey hapun for Nemesio Díez stadium for Round 16 show say Cruz Azul no come joke at all, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Uchenna Kanu show dem level again for Cruz Azul
The 28-year-old player enter this match with ginger after she score two goals for dia last game wey dem lose 3-2 to Atlético de San Luis. But this time, she carry the team for head and dem win well-well.
Her first hat-trick for this season hapun for Round 10 when she lead the team beat Atlas Women 6-4 back in February.
With the goals wey she score for Sunday morning so, Kanu don score for back-to-back matches. Now, she don get 10 goals for inside her last eight games—that na total of 11 goals for the whole season (including one friendly match).
Cruz Azul start the game with high tension. Kanu open floor for 14th minute, and before anybody talk “pree”, she double the lead 11 minutes later.
Ana Martínez come add the third goal small time after second half start, before Kanu complete the wash-out for 88th minute. Throughout the match, Toluca players just dey chase shadow as Cruz Azul attack dey bite.
Even though dem win, Cruz Azul still dey 7th position for table with 30 points. Dia next focus now na the last match against Pumas next Saturday.
Adugbe and Duru shine for Žalgiris heavy away win
No be only Kanu dey represent, as the same levels hapun for Lithuania A Lyga Women. Olamide Adugbe and Joy Ndidi Duru show say Nigerian babe no dey carry last as dem help MFA Žalgiris Women win 4-0 for away.
Adugbe score the third goal for the match against FK Transinvest for dia Round 4 clash. Her sister-girl, Joy Duru, na she first open door with one fine finish to set the mood.
This na Adugbe third goal for the season after she first score two for dia opening match.
MFA Žalgiris just dey control the game anyhow. Duru score early-early, then Ugnė Lazdauskaitė add the second goal for 67th minute.
Just two minutes later, Adugbe wire the third one, before Lazdauskaitė come finish the work with her second goal for 71st minute.
Because of this win, MFA Žalgiris don climb go 3rd position for the league table with six points from three matches.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 5, 2026 11:26 am by Hitvibz Media



Stay connected