My people, Asisat Oshoala still dey scatter nets left, right and centre o! But this time, her early goal no save Al Hilal from chop 3–1 wotowoto from Al Nassr for Saudi Women Premier League.
She just return from national duty where she help Super Falcons knack Benin Republic 3–1 on aggregate qualify for WAFCON 2026, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Asisat Oshoala Burst Net Early, But Al Hilal Come Lose Focus
Babe no even rest—she carry that same firepower enter Riyadh and still burst net again.
Na just nine minutes dem use see pepper. Oshoala and her Portuguese padi, Jessica Silva, do one sweet give-and-go wey tear Al Nassr defense open. Boom! Oshoala slot am calm like she dey collect alert. 1–0.
But Al Nassr no gree. Before halftime sef, one madam Ruth Kipoyi equalise put everybody for reset mode.
Second half never too start, 15 minutes later, Clara Luvanga show herself—2–1. As if that one no do, she come add another one for injury time. Na that one nail coffin. Al Hilal collect their first L of the season. Na proper gbese!
Oshoala Still On Fire, But Al Hilal Don Drop to Second
Even though dem lose, Asisat Oshoala still dey shine like generator wey just service. That her goal don carry her tally go five goals plus two assists for just five games.
Babe dey score steady—five straight matches back-to-back: Al Qadsiah, Al Ahli, Neom SC, Al Ittihad, and now Al Nassr. Na cruise queen be that!
But as dem collect this kind 3–1, Al Hilal don waka go second place with 12 points. Al Nassr don carry table top with 15.
Still, make nobody play with Asisat Oshoala oo—she dey form wey fit turn table upside down anytime. If Al Hilal go bounce back, na her leg dem go still use am do am.
Na so football be—today na tears, tomorrow fit be champagne!
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on November 6, 2025 7:42 pm by Hitvibz Media



Stay connected