Super Falcons babes show say dem no come play for WAFCON 2024, as four of our players land for the tournament correct Best XI.
CAF – the people wey dey run African football – don drop their official Best XI for WAFCON 2024, and Nigeria carry heavy presence inside, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Four Super Falcons Babes Make Africa Best List
Chiamaka Nnadozie, Michelle Alozie, Esther Okoronkwo, and Rasheedat Ajibade all make the list, prove say Naija still dey run things for African football.
Dem arrange the Best XI for 4-3-3 formation – to showcase the best ballers for every angle.

Chiamaka Nnadozie land the number one spot as best goalkeeper – no be surprise, as she collect Best Goalkeeper award for how she take lock post like padlock throughout the tournament.
Michelle Alozie hold down the right-back like soldier, as her hustle no dey ever finish and she defend steady for all the matches.

For front, na Esther Okoronkwo and Rasheedat Ajibade dey scatter wings – left and right respectively.
Okoronkwo wey win MVP for the final against Morocco, score some solid goals and even dash six assists in just six matches – two for the final sef!

Ajibade no dull – she collect Best Player of the Tournament, as she bring ginger, speed, and serious leadership wey help Naija waka go final.
Other players wey make the list include South Africa’s Bambanani Mbane, Ghana’s Grace Asantewaa, and Morocco’s Ibtissam Jraidi.

WAFCON 2024: Naija Carry Head High
As four of Super Falcons babes land for the Best XI, e just confirm say Naija no dey joke when e come to women football.
Dem no only carry the WAFCON trophy for the 10th time, dem also chop most of the individual awards.
The stars who shined the brightest. ⭐
Meet your Best XI of the Tournament!#TotalEnergiesWAFCON2024 pic.twitter.com/dXWZNAzHqU
— CAF Women’s Football (@CAFwomen) July 28, 2025
From Nnadozie wey block shot like wall, to Ajibade wey dey tear defense anyhow, these Super Falcons babes don show again say dem be the queens of African football.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 28, 2025 11:37 am by Hitvibz Media

Stay connected