House of Reps don drop one serious plan wey fit change how 2027 Elections go happen for Nigeria.

INEC Fit Run 2027 Elections One Day – See Wetin House of Reps Dey Cook!

Dem wan make INEC run everything — presidential, gubernatorial, senate, House of Reps, and state assembly elections — on top one single day, na weytin hitvibz dey yan be dat.

House of Reps Wan Combine All Elections for 2027

If dem pass this plan, e go be major shift wey go affect both voters and politicians.

This Electoral Bill 2025 wey House of Reps dey propose get plenty twist wey you gatz know.

INEC preparing for 2027 Elections with new House of Reps rules

If dem approve this new Electoral Bill 2025, INEC go get full authority to organize all 2027 Elections one day.

Dis go include president, governors, senate, House of Reps and state assembly — all for the same date.

The matter dey serious because the House of Rep wan reduce election stress, spending, and improve participation across Nigeria.

  OPM Pastor donate 300 branches to INEC as PVC registration, collection centers

For inside the new proposal, political groups wey wan register as party go need drop N50 million first before dem go fit even talk say dem wan contest. Na big money matter!

New Spending Limits and Party Replacement Rules

House of Rep no just stop for election dates. Dem still arrange strong laws for campaign spending and election conduct. For example:

Presidential campaign limit: N10 billion

– Governorship campaign: Raised from N1 billion to N3 billion

– Senate: N500 million

– House of Reps: N250 million

– State Assembly/Chairmanship: N30 million

– Councillor: N10 million

Dem still add say no individual or organisation fit donate more than N500 million to any candidate.

  Hunters recover 320 PVCs in uncompleted building in Bayelsa

Dis one na to block political godfathers from controlling elections.

Another hot angle na how dem wan stop the by-election wahala wey dey always happen when person resign or die.

House of Reps propose one-day voting for 2027 Elections

House of Representatives dey talk say na the political party wey support the original candidate go bring new person to replace am.

Na Serious Wahala or Better Plan?

As 2027 Election dey near, the House of Rep dey push strong moves to make INEC handle elections better and faster.

With Electoral Bill 2025, Nigeria democracy fit enter new level — if dem do am well.

  2023 Election: Nigerians should commend INEC - Wike

Whether na better plan or another election drama, Nigerians go soon find out. But for now, everybody dey watch how this one go play out for National Assembly.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 28, 2025 2:06 pm by Hitvibz Media